Ghanaian legendary artiste Daddy Lumba don die

Wia dis foto come from, Daddy Lumba/facebook
Legendary Ghanaian highlife artiste Charles Kojo Fosu wey dey popular as Daddy Lumba don die.
E die at di age of 60.
For inside one statement wey di lawyer for di family release, e say "Daddy Lumba die Saturday on 26 July 2025 afta short illness."
"Daddy Lumba na more dan musician, e be cultural icon as im music bin touch countless lives," di statement wey lawyer Fati Ali Yallah don sign tok.
Di family add say "im soulful voice provide soundtrack to our love stories and im poignant lyrics bin capture di poetry of our struggles, dreams and resilience."
Tori bin comot on Saturday morning say di highlife legend don die bifor di family officially release di statement.
Dem tok say "during dis time of ogbonge loss, we request privacy for di family and loved ones as dem try to accept dis profound grief."
Details of di funeral arrangement go dey public for di coming days, di family add.
Afta di tori of im death spread, im radio station for Accra (DL106.8 FM) begin pay tribute to di legend wit some of im songs for di air waves.
Dem also write on top dia social media handle say "35+ years for di music industry wey still bin dey compete wit di gen Z's. Dat na Daddy Lumba and im legacy."
Daddy Lumba na ogbonge artiste for di kontri and im music cut across generations.
Daddy Lumba bin attend one recent event for Valentine on 15 February 2025 for di Accra international conference center.
E perform many of im love songs togeda wit oda musicians.
For most of im concerts, ogbonge politicians, former president John Kufour, and odas bin dey attend.
Profile of Daddy Lumba: Pipo say e be di most influential Ghanaian artiste

Wia dis foto come from, Daddy Lumba/facebook
Di legendary artiste don get music career wey span ova 30 years. Pipo sabi am as "di most influential musician for di history of Ghana," according to tori on top im official website.
Ogbonge musicians for Ghana today bin consider am as dia inspiration for di highlife music genre ; artiste like Ofori Amponsah, Kuami Eugene, Kidi, Oheneba Kissi and odas.
Dem born Daddy Lumba 29 September 1964 for Nsuta for di Ashanti region.
For di early 1980s wia im music career don begin when im form di Nkwanta Wesley singers band wey become popular for di region.
According to gist on top im website, im get di name Lumba afta im compose one song wit di title 'lumba lumba' wey im dedicate am to di freedom fighters for South Africa at dat time.
Na so di song don become popular wey im get di nickname 'Daddy Lumba'.
E also form di 'Lumba brothers' band for im school those days, wey include im girlfriend.
Daddy Lumba bin travel go Germany afta im studies, for there e meet anoda Ghanaian musician Nana Acheampong, and dem form anoda group 'Lumba brothers' band for dia.
Di group release dia first album 'Yee ye aka akwantuom' for di year 1986.
Di two don split and Lumba launch im solo career and release debut solo album "Obi ate meso buo" for 1990.
Di legendary highlife artiste don release 33 albums for im career wit many popular songs.
Some of im popular albums na "sika sem" "Aben wo ha" "Wo ho kyere" "Awosoo", " Give peace a chance" and "Ahenfue Kyinkye".
Im latest project na "Ofon na edi asem fo" wey dem release for December 2022.
Daddy Lumba apart from im own career don mentor and train odas like Felix Owusu, Afia Ampofowaa, Kwabena Sunmwa, Ofori Amponsah, Ateaa Tina and odas.
Tributes for Daddy Lumba
Media personality wey bin work closely wit Daddy Lumba, Serwaa Amihere tok say "we dey sad to announce say our legend don die."
"Dis na hard moment for us even bifor we come on air to announce im death."
"Daddy Lumba na di greatest musician of all time, im death an ogbonge blow to us and di music world," Serwaa Amihere bin add.
"Make everibodi wey bin dey love di legend pray for im wife and children at dis time."
Former vice president Dr Mahamudu Bawumia write say "Lumba na true music icon wey bin get incredible career ova three decades."
"Na big blow not only to di music fraternity, but to di entire kontri. Me and my wife Samira don extend our condolence to im wife, family, fans and di whole kontri."
Director for Diaspora Affairs for di Office of di president Kofi Okyere-Darko write on top im social media say "Lumba na di greatest from Ghana in di last 100 years."
"Di source of everitin I don become, rest well papa, tank you," Kofi Okyere-Darko add.
Ghanaian musician Sista Afia write say "I don dey very heartbroken."
Anoda rapper M.anifest tok say "Lumba na iconic."
Chief editor for di United Nations Dailies Ben Dostei Malor describe di late legend as "one beloved Ghanaian icon wey don die"
"Make im soul rest in peace na so God for comfort im family and fiends."
Anoda Ghanaian rapper Guru describe am as "di pacesetter of our time."
Socialite and social media influencer Efia Odo write for twitter (formerly X) say "Ghana dey mourn, Africa dey mourn. Di world don lose ogbonge musical legend."
"Daddy Lumba na more than musician, na im be voice for di broken, poet for di pipo and melody wey bin live for di heart of every Ghanaian."









