Who be Ghanaian former fetish priestess Patricia Asiedu 'Agradaa' wey court jail for 15 years

Wia dis foto come from, EVANGELIST PATRICIA ASIEDU/INSTAGRAM
One circuit court for Accra don jail former fetish priestess Patricia Asiedu wey pipo sabi as 'Nana Agradaa' to 15 years.
Dis na afta di court find her guilty say im use religion to advertise and defraud pipo of dia money.
Patricia Asiedu aka Nana Agradaa for many years bin dey advertise on top TV station say she gat powers to double money for pipo.
She bin dey call am 'sika gari' wey mean say she fit double money give pipo wit her powers.
Many wey she allegedly dupe through di scheme bin report to police say afta dem pay consultation money to her, wia she collect dia deposit, dem no get di doubled money wia she promise.
Police for 2021 bin arrest her say she dey operate two TV stations (Thunder TV and Ice TV) illegally.
Di Accra circuit court bin release am on GHC500,000 bail dat time wia she continue to dey attend court hearings.
But four years down di line, di court don find say she dey guilty of "defrauding plenty pipo as im lie to dem say she fit to double dia money give dem."
Dem bin charge Patricia Asiedu aka Nana Agradaa for seven offenses wey include charlatan of advertisement contrary to section 137(1) of act 29 and defrauding by false pretenses contrary to section 131(1) of di same act.
For di court documents, di complainants against Nana Agradaa plenty pass one thousand pipo.
Dis pipo bin attend one watch night service for her church wia dem give different amount of mon eysay make she go double di cash give dem, as she bin promise for her adverts on top her TV stations.
But Nana Agradaa no fit double di money for di many pipo wey attend di watch night service.
Di court wia Her Honour Evelyn Asamoah bin preside over, order say make dem carry her to do pregnancy test bifor she go sentence her.
Na so afta dem comot di hospital to do di pregnancy test, di court jail am for 15 years.
Di decision by di court dey mark wetin sabi pipo tok say na ogbonge step against fraudulent spiritual scams wey full TV stations and social media.
Afta di judgement, her lawyers tok say di ruling "na travesty of justice."
Lawyer Richard Asare Baffour tok say "dem bin jail Agradaa no be sake of wetin she do, but sake of who she be."
Im tok say dem defend dia client for all di counts but di court still go ahead to deliver dis kind judgement.
As dem bin day escort her to di prison she tok say make her church members continue to pray for her.
Profile of Patricia Asiedu aka Nana Agradaa

Wia dis foto come from, EVANGELIST PATRICIA ASIEDU/INSTAGRAM
For 2021 afta police pursue her ova her money ritual adverts on top her TV stations, Nana Agradaa tok say she repent as fetish priestess wia she don accept Jesus.
Na so she allow make some ogbonge men of God burn wetin she describe as idols for her shrine.
She say she don become born again.
She now set up di heaven way international church.
Since 2022, she and her husband bin dey run di church wey dem get followers.
Most Sundays, she dey preach about prosperity to her church members.
She also bin get one defamation case against her afta one gospel musician Empress Gifty Osei sue her say she defame am.
Dat mata still dey di Tema court wey dem neva judge am finish bifor dis 15-year jail term don land on top her head.
Nana Agradaa dey popular on top social media wey she get many followers.
On Tuesday, 1 July 2025, dem invite am togeda wit her husband to di country National prayer and thanksgiving day.
She even hug di President John Mahama, afta di prayer and thanksgiving service wia she tok say "I don hug di president now. Even if I neva go heaven, I dey fulfilled"







