FBI carry popular Ghanaian businessman Dada Joe Remix go US to face charges of wire and romance scam

Wia dis foto come from, DADA JOE REMIX/TIKTOK
Di Federal Bureau of Investigation (FBI) don carry one ogbonge Ghanaian businessman Joseph Badu Boateng aka Dada Joe Remix go di US to face charges of wire and romance fraud.
Dis dey happun weeks afta di US attorney general, Pamela Bondi tok say dem dey "pursue evribodi wey dey involved for transnational schemes wey cost billions of dollars, wey be how dem dey steal moni from old pipo".
"For di last few weeks alone, investigators and prosecutors don arrest wia dem file cases against foreign fraudsters wit domestic actors wey bin dey help di foreign-based crimes," di statement on top di US Deportment of Justice website tok.
Di Attorney General office tok say dem dey work wit "domestic law enforcement and dia counterparts for oda kontris to find dis criminals to face justice".
Some of di crimes dem tok say dis pipo bin commit involve romance scam, lottery fraud and grandparent scams.

Wia dis foto come from, Diplomatic Security Service/Facebook
Na so di diplomatic security service special agents for di US embassy bin work wit di FBI wia dem extradite oga Dada Joe Remix for Tuesday 1 July 2025.
Inside one statement on top dia social media page, dem tok say "di diplomatic security service special agents work wit di FBI to carry oga Dada Joe go di US".
Dem add say "oga Joseph Boateng aka Dada Joe Remix dey indicted on top charges say im run ogbonge fraud cartel wey bin use romance and inheritance scam to defraud US victims of millions of dollars".
End of Di one wey oda users dey read well well
"Di pesin now dey for di US to face justice," di statement tok.
Dada Joe Remix na one of ten Ghanaians wey di US authorities bin dey pursue for various scams wey dem bin allegedly use to defraud plenty US citizens.
Background

Wia dis foto come from, Diplomatic Security Service/Facebook
Di US Department of Justice tok say dem file case against Joseph Kwadwo Badu Boateng wey pipo for Ghana sabi as 'Dada Joe Remix'.
On 30 May, one jury for di district of Arizona bin charge am wit conspiracy to commit wire fraud and conspiracy to commit money laundering.
According to court documents, dem bin dey dis fraud business between 2013 and March 2023, wen Boateng and oda pipo wey im dey work wit, don do romance/inheritance scheme wey target elderly American pipo.
Di pipo im dey work wit (co-conspirators) bin "use false means say dem get gold and oda jewels, na so to release dis tins, dem gatz pay taxes and oda moni; dat be how dem dey collect victims dia moni."
Authorities for Ghana bin arrest Dada Joe Remix on 30 May 2025, wia dem begin di process to extradite am to di US on di request of American authorities.
Na FBI wey investigate dis mata.
Who be Dada Joe Remix?
Dada Joe Remix na popular pesin for Ghana wey pipo for di entertainment industry dey describe as "business mogul and philanthropist".
Im dey associated wit plenty of di entertainment industry pipo like Shatta Bundle, Showboy, Abutrica and odas.
Im dey flaunt luxury cars and oda properties and dem tok say im dey involved in real estates, oil and gas among odas.
For September 2024, many of di kontris celebrities bin attend di funeral of im papa for Accra - na ogbonge funeral.
Since May dis year, FBI agents bin dey di kontri to pursue Ghanaians wey allegedly dey involved for crimes against US citizens.
Dem bin work wit Ghana authorities to arrest entertainment industry player Isaac Kofi Oduro alias Kofi Boat wey be godfather to one of Ghana dancehall artistes, Shatta Wale.
Togeda wit Inusag Ahmed, Derrick Van Yeboah and Patrick Asare, di US authorities say dem dey involved for one ogbonge million dollar fraud mata wey involve wetin dem describe as Business Email Compromise (BEC) and romance scam.
Di arrest wey happun on 13 June 2025, afta di kontri interior ministry bin secure warrant for di District Court for Accra, na part of joint Interpol and FBI operation afta US indictment charge dem wit wire fraud and money laundering.














