Nollywood actor Allwell Ademola make her final journey

Friends, family and well wishers show for di burial of Nollywood actress, writer and producer, Allwell Ademola wey hapun for Atan, Yaba Cemetery on Friday January 9, 2026.
For di burial friends, family and well wishers wear white
Di multi-talented actress bin appear for screen acting, she bin also do stage acting, wey include for di National Theatre.
For 2006, she bin release album wit di band Allwell and Company.
Her death shock many pipo especially her fans and di Nollywood industry wey still dey mourn.

Her broda , Adeboyega Adebayo tok say im neva still digest di news about her death as im add say im dey miss evritin about her.
"To grow up togeda wit her, she bin dey veri adventurous, neva bullied and neva intimidated, wit her size she no get anytin like low self esteem."
Im describe di late [Allwell] as one of im two body guards for life. "She bin dey physically strong, vivacious and full of life na so she take enta inside acting sake of say she bin want to dey out there.
She dey so bold, she fit tok to crowd, she no go any speech school, she no learn am from anywia.
Pipo for di industry dey tell us say make we no cry, say she don already impact pipo.” E tok.
Reports say Allwell die on December 27, 2025 at di age of 49 afta she fall sick for her house.
Na her family later confam her death for statement wey bin clear di rumours and tori wey bin dey fly upandan.
For di statement, wey Adegboyega Adebayo sign on behalf of her family to announce her passing, dem tok say she die on Saturday, 27 December at di age of 49.
"Wit heavy hearts and total submission to di will of God, we announce di passing of our beloved sister, mother and aunt Princess Allwell Ademola wey comot dis world on Saturday, 27th of December at di age of 49," di statement read.
Di cause of her death no dey announced officially.
Some fotos from di burial












