Manchester City go jam Real Madrid for Uefa Champions League play-off

Wia dis foto come from, Getty Images
Di draws for di play-off of phase of di new Uefa Champions League format wey happun dis Friday for Neon, Switzerland don throw up exciting match ups.
Di biggest draw na Manchester City vs Real Madrid, di current. defending champions for England and Spain respectively.
Dis play-off phase na new addition to di competition and na dis 2024/2025 season be di first time dem dey try am.
Remember say instead of group phases, di Champions League dis year dey like normal league table, wia each team go play a total of eight games for di first round.
Afta dis first round, di teams wey dey from position one to eight for di table go automatically qualify for di round of 16, while teams nine to 24 go play a two-legged play off - home and away - and di winner by aggregate go also qualify for di round of 16.
Teams for di knockout play-off of 16 draw
- Atalanta vs Club Brugge
- Borussia Dortmund vs Sporting CP
- Manchester City vs Real Madrid
- Celtic vs Bayern München
- Feyenoord vs AC Milan
- Juventus vs PSV
- Brest vs Paris Saint-Germain
- Monaco vs Benfica
First legs - 11 and 12 February, 2025
Second legs - 18 and 19 February 2025.
Who go meet who for di last 16?
Liverpool and Barcelona no go meet each oda until di final as dem finish first and second for di table.
End of Di one wey oda users dey read well well
Both teams go meet either Monaco, Brest, PSG or Benfica for di round of 16.
Arsenal, wey finish third go face either Feyenoord, Juventus, AC Milan or PSV.
Aston Villa - eighth on di table - go meet either Sporting Lisbon, Club Brugge, Atalanta or Borussia Dortmund.
Di draws for di round of 16 go happen on 21 February and di matches go be for March 4/5 and 11/12.













