How Comoros beat Ghana for dia World Cup Qualifying game

File foto of Comoros players dey celebrate

Wia dis foto come from, X/@fedcomfootball

Hertha Berlin striker Myziane Maolida be star of di match as im brilliant solo goal win all three points for Comoros against di Black Stars of Ghana for dia 2026 World Cup qualifier.

Di 43rd minute goal separate di two sides afta 90 minutes of football wey see di Black Stars struggle.

Di defeat be di Black Stars dia second consecutive loss against Comoros afta dia 2021 Afcon 3-2 defeat for group stage.

Antoine Semenyo miss one chance to open di score before Comoros forward Maolida take im chance before halftime.

Black Stars coach Chris Hughton sub captain Andre Ayew wia im bring Mohammed Kudus.

Despite say oda subs like Ernest Nuamah and Majeed Ashimeru come change di game, di Black Stars no fit get di equalizer.

Comoros defend well well to hold on to dia 1-0 win.

Wit di win, Comoros don go top of Group I wit six points afta dia 4-2 win over Central African Republic last Friday.

Mali don draw wit Central African Republic on Monday so dem dey 2nd wit 4 points.

Madagascar dey 3rd wit 3 points wia Ghana dey 4th also wit 3 points afta dia last-gasp 1-0 win against Madagascar for Kumasi on Friday.

Match highlights

Second half

Full time Comoros 1-0 Ghana.

Referee don blow whistle for di end of di game for di Moroni stadium

90+4’ Comoros goalkeeper waste some time before im take di goal kick.

92’ Ghana try to create chance but Comoros defender Yaccine Bourhane clear di danger.

91+1' Di players don taya. Comoros player Rafik Said take im shot go throw.

90' Referee give 5 minutes added time.

89’Ahmed Mogni take di freekick. Richard Ofori save am easy.

88’ Comoros win freekick afta Black stars defender foul Ahmed Mogni just outside di box

88’ Ghana don make anoda substitution. Jonathan Sowah don replace Baba Iddrisu.

86’ Mohammed Kudus strike one from di edge of di box afta Ernest Nuamah clip one ball from di left side to di Westham forward. But keeper catch di ball afta di second attempt.

84’ Substitution for Comoros. Younn Zahary replace Faiz Selemani.

82’ Ernest Nuamah hit one cross from di right hand side wey comot park.

80’ Ghana goalkeeper comot im line wia Ben Biona hit one long ball dey try catch am off im line, but Richard Ofori catch di ball.

80’ Substitution for Ghana. Leicester city player Fataw Issahaku replace Jordan Ayew.

78’ Referee don show Comoros reserve goalkeeper yellow card for bench afta im complain about di decision to give Ghana a freekick.

76’ Ghana don win anoda corner. Kudus play di ball give Jordan. Di striker lay ball for Gideon Mensah but im cross hit Comoros wia im go corner.

75’ Comoros dey try play some tiki-taka for Ghana im yard. Ghana defenders don clear am.

73’ Ghana dey pursue di Comoros goal area.

Afta series of attacks on di goal area Jordan Ayew don shoot di ball wide from distance

71’ Counter attack for Comoros three players aginst two but di attacker take di ball hit defender.

67’ Comoros substitution Ahmed Mogni replace goalscorer Myziane Maolida.

65’ Ernest Nuamah wey just enta start to pressure di Comoros keeper afta one ball over di top. Di ball manage enter net but referee whistle for foul against di Lyon striker.

64’Double substitution for Ghana. Ernest Nuamah and Majeed Ashimeru don come on for Abdul Salis and Antoine Semenyo

62’ Jordan Ayew manage take ball run thru di middle of di park wen im pass di ball forward but di Ghana player miss di ball.

60’ Ghana don dey create sometin. Baba Iddrisu lay one pass for Gideo Mensah.

Di defender cross ball for box but nobody fit connect.

58’ Comoros don make one substitution. Rafik Said replace Bendjaloud Youssouf .

57’ Jordan Ayew play im ball over di top for Inaki Williams no find am.

Comoros keeper Ben Biona don comot come claim di ball inside air.

53’Atlethic Bilbao striker Inaki Williams head di ball over di bar, na fine chance wey Jordan Ayew create wit im cross from di top right hand side.

51’Antoine Semenyo don flash im header wide from a cross.

50’Jordan Ayew take di corner, but Comoros don clear danger for yard

49’ Ghana get corner. Bournemouth striker Antoine Semenyo drive di ball for di line but im cross hit Comoros defender for corner.

48’ Youssouf don return to di field afta treatment.

Comoros get freekick afta Denis Odoi foul im marker.

46’ Comoros captain Youssouf M’changama don twist im ankle.

Medical team dey treat am as im coach dey hope say no be serious injury

46' Substitution for Ghana.

Westham forward Mohammed Kudus don dey replace captain Andre Ayew

46' Second half don start.

First Half

Comoros 1 Ghana 0

First half don end.

45+3’ Jordan Ayew dey try squeeze thru di Comoros defence but di rock for di back block am. Di Palace striker fall for ground, referee say no freekick.

45’ Di black stars don dey force dia way to get equalizer before halftime. But Comoros don dey defend well well.

Comoros 1-0 Ghana

42’ Goal! Comoros don score!

Myziane Maolida shoot from inside di box afta e beat Nuhu and Nicholas. Di ball beat Ghana goalkeeper Richard Ofori.

40’ Both teams dey struggle to play di final ball. Plenty pass no dey equal goal.

38’ Ghana dey try create something before di halftime whistle but Comoros clear dia lines.

36’ Di Orlando Pirates keeper Richard Ofori don stand up. Im go fit continue di game afta di treatment. Referee restart di game.

33’ Ghana goalkeeper Richard Ofori dey receive treatment for eye. Di referee don stop di game. Di golkeeper judt call for medical attention by imsef.

32’ Chance for Comoros, two players pass di ball for di Ghana area wey di striker try shoot wit im left foot but Defender Nuhu use boot balloon di ball from di area.

31’ Di crystal palace striker hit di freekick over di bar.

30’ Freekick for dangerous position for di black stars. Comoros defender don foul Antoine Semenyo. Di ball dey just outside di box. Jordan Ayew dey stand di ball im back.

28’ Comoros afta slow buildup don lift di ball over di top for striker but goalkeeper Ofori don comot come catch ball

26’ Di game don hot now. Both teams dey create chances wia dem dey possess di ball.

24’ Ghana goalkeeper don save one cross into di area from di corner. Di ball almost creep enta net.

23’ Comoros get counter attack afta Semenyo lose di ball for midfield.

Dem win corner kick from dat attack.

21’ Black stars manage create chance straight afta di Comoros attack.

Inaki Williams cross from di right side. Jordan Ayew head di ball wide.

20’ Comoros hit dia first shot on target afta some good interplay for midfield.

Captain Youssouf M’changama wit di shot but goalkeeper Richard Ofori don save am.

18’ Referee don blow whistle for offside against Comoros.

14’ High foot challenge on Semenyo on im marker. Ref blow whistle for freekick for Comoros

13’ Denis Odoi from Ghana don hit one pass too hard wey e go out of play

11’ Chaaaance…. Comoros get dia first chance afta one lose pass from di black stars. Di player don hit am hard from distance but e go way off target.

9’ Anoda freekick for di black stars. Crystal Palace striker Jordan Ayew wey win am for di half of Comoros.

6’ Chance for Ghana. Antoine Semenyo strike di ball off to di side net.

Na big chance be dat Inaki Williams play di through ball to Semenyo, wia im don take one touch before shooting di ball wide.

4’ Black stars don win dia first freekick wit one high foot challenge on captain Andre Ayew.

3’ Everytin don dey slow. Both teams dey try hold di ball den play some passes

2’ Corner to Comoros as captain Youssouf M’changama don hit di ball into di black stars area.

1’ Referee don blow whistle for game to start.

1’ Under one minute, Comoros don get two free-kicks for dia half.

Head to Head

In dia last six matches for all competitions, Ghana bin get three wins, dem lose two and draw one.

Comoros bin neva lose any of dia last three matches, dem win two draw one.

Di last competitive match wey dem jam na for di 2018 Caf World Cup qualifiers.

Dia first meeting end goalless while Ghana win di second one by two goals.

Line ups

Ghana Line-up: Richard Ofori, Denis Odoi, Nicholas Opoku, Nuhu Adams, Gideon Mensah, Baba Iddrisu, Jordan Ayew, Andre Ayew, Abdul Salis, Inaki Williams, Antoine Semenyo.

Comoros Line-up: Ben Biona, Said Bakari, Younn Zahary, Kassim M’Dahoma, Abdul-Hakim Abdallah, Yacine Bourhane, Faiz Selemani, Youssouf M’Changama, Benjaloud Youssouf, Rafiki Said Ahamada, Myziane Maolida