Nigeria secure anoda draw for dia 2026 World Cup qualifier against Zimbabwe

Kelechi Iheanacho

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Super Eagles of Nigeria no fit fly well afta Zimbabwe hold dem to a 1-1 draw for di 2026 World Cup qualfiers.

Na for neutral ground Rwanda wey di match shele.

Zimbabwe score di first goal for di 26th minute through Walter Musona.

Di Super Eagles wey no too play well wait till di 67th minute before Kelechi Iheanacho score for Nigeria.

Second half

Full Time Zimbabwe 1-1 Nigeria

90+7 Match don end

90' Six minutes added time

88' Jamilu Collins collect yellow card afta e foul Zimbabwean player, referee give dem freekick but Nigerian defence block am.

84'Di match don dey intense and high competition as dem dey battle for di winning goal

76' Nigeria don up dia game afta di equalizer, but Zimbabwe still dey hold dem for work

Zimbabwe 1-1 Nigeria

67' Goal!! Kelechi Iheanacho score di equalizer for Nigeria.

64' Freekick for Nigeria but Zimbabwean defence clear di ball out.

51' Zimbabwe still dey dominate di match for dis second half

46' Second half don start

First half

Zimbabwe 1-0 Nigeria

45+3 Referee blow whistle for Half time

45'Calvin Bassey of Nigeri collect Yellow card.

42' So far na battle of midfields as di wo teams no dey let each oda pass di midfield.

36' Nigeria captain for dis match Moses Simon play beta shot from outside di box but Zimbabwe goalkeep catch di ball.

31' Zimbabwe get freekick but Nigeria defence block am.

31' Zimbabwe dey control di game wit beta passes as Nigeria dey try to catch up

Zimbabwe 1-0 Nigeria

26' Goal!! Zimbabwe don score di first goal for d match from more dan 30 yards distance. Di player Walter Musona smash di ball into di top corner of di net.

24' Zimbabwe dey worry Nigeria defence well well.

21' Nigeria bin get corner kick but notin comeout of am.

19' Zimbabwe bin get clear chance to take di lead but Nigeria goalkeeper Francis Uzoho run comeout to catch di ball.

17'Onyemachi play corner kick for Nigeria for e go wide.

16' Zimbabawe bin get chance to enta Nigeria defewnce but dem block am.

14' Nigeria do 0ne , two passes for Zimbawe defence but dem block am, e later result to freekick afta Nigeria bring one Zimbabwe player down.

13' Di two teams neva get beta chance to score

11' Nigeria dey dominate play so far

1' Match don start o!

Zimbabwe vs Nigeria match preview

Nigeria go meet Zimbabwe as di Super Eagles hope to redeem diasef afta dia uninspiring 1-1 draw against Lesotho on Thursday for di 2026 World Cup qualifier.

Di first match for Nigeria bin shele for dia homesoil for Godswill Akpabio Stadium for Uyo, di Akwa Ibom State capital but di result rubbish di many predictions ahead of di match against Lesotho.

Di Super Eagles bin lose many chances wey dem suppose utilise to coast home to victory on Thursday, and all eyes dey on dem now as pipo dey watch if dem go fit change dia fortune wen dem meet Zimbabwe for Rwanda Southern Province of Butare by 2pm Nigerian time today.

Wetin fit ginger Zimbabwe for today match na how Lesotho bin stand gidigba against Nigeria and dia own performance against Rwanda on di same day.

Although Zimbabwe match against Rwanda for Stade Huye on Thursday bin end for 0-0 but dem display correct energy, only be say dem dey unlucky not to score.

Na di same Stade Huye Zimbabwe adopt as dia home ground for di match against di former African champion and na only time go tell which team go sing di song of victory.

Zimbabwe vs Nigeria head to head

Nigeria win four of dia last seven meetings wit Zimbabwe and draw two.

Dia only loss na for one international friendly for August 1981.

Zimbabwe vs Nigeria line-ups

Nigeria Line-up: Uzoho, Aina, Ajayi, Onyemaechi, Bassey, Aribo, Onyeka, Iwobi, Tella, Simon, Moffi.

Zimbabwe Line-up: Donovan, Hadebe, Mbeba, Takwara, Zemura, Nakamba, Munetsi, Rinomhota, Dube, Kadewere, Musona.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Nigeria team news

For dia first match, di Super Eagles bin miss di ogbonge Napoli striker Victor Osimhen sake of injury, and today dem go miss anoda ogbonge striker Taiwo Awoniyi for di same reason.

Awoniyi no travel wit im colleagues sake of injury and im don return to England where Nottingham Forest doctors go try dia best to ensure say e get back in shape on time.

Na Awoniyi and Victor Boniface bin lead di Super Eagles attack against Lesotho but Coach Jose Peseiro go make changes sake of Awoniyi absence today.

Today match dey raise question about di future of Peseiro wit di Super Eagles as speculation dey fly around say di Nigeria Football Federation fit sack am if Super Eagles lose to Zimbabwe today.

However, di 63-year-old Portuguese go need prove imsef today.

Zimbabwe team news

Zimbabwe coach Baltemar Brito go wan make im players maintain di same energy against Rwanda wit Nigeria today but dis time around dem go wan ensure say dia chances result in goals.

Di Warriors bin set up 3-5-2 formation and dem give Rwanda a run for dia money on Thursday.

Brito tok say pipo go expect revenge from Nigeria sake of say dem draw dia first game against Lesotho but warn say di West African kontri no dey play against small or weak nation today.

“Dem go come strong, but we go come strong too. We dey here to face dem,” Brito tok.