Inaki Williams score late winner to help Ghana beat Madagascar for 2026 World Cup qualifier

Wia dis foto come from, Getty Images
Inaki Williams last minute strike help Ghana to an important 1-0 win over die hard Madagascar.
Di Atletico Bilbao forward score im first goal for Ghana inside di last minute of di game.
Di visitors bin put up a very good for di Baba Yaro stadium for Kumasi on Friday night.
Madagascar team also hit bar for di second half. Dis na afta an impressive first half performance.
But wit strategic changes by Chris Houghton Ghana begin press dia opponents from all angle.
Efforts by Ousman Bukari and Kudus from both wings make di Black Stars begin break.
Na for di 96th minute Ghana finally try to find Inaki Williams wit a high pass wey di player head into di net
Ghana dey for Group I wit Central African Republic, Chad, Comoros and Mali.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Second Half
90mins: Tsiry Randriantsiferana delay pass inside Ghana 18 yard
88mins: Odoi try make run through di right but Madagascar defenders stop am
86mins: Ghana dey press wit everi tin wey dem get. Dem dey desperate now
84mins: MISSED CHANCE! Kudus miss good goal scoring opportunity
82mins: Substitution! Ousman Bukari enta for Andre Ayew
81mins: Na 10mins to go abd Madagascar go happy wit a draw away from home
Ghana 0-0 Madagascar
80mins: Anoda wonderful save by Adrien Melvin
77mins: Good bicycle kick from Inaki Williams
75mins: Madagascar goalkeeper Adrien Melvin make 2 important saves
74mins: Ghana comot Antoine Semenyo for Ernest Nuamah
72mins: Substitution for Madagascar - Tsiry Randriantsiferana for El Hadary Raheriniaina. Louis Demeleon also enta for Rajo Razafindraibeharimihanta
71mins: Ghana dey do evri tin to unlock di opposition defence
70mins: Substitution for di visitors - Dorian Bertrand comot for Tendry Mataniah
67mins: Kudus waste free kick just at di edge of di area
63mins: Substitution! Daniel Amartey comot for Kasim Nuhu
57mins: Substitution for Madagascar - Lalaina Rafanomezantsoa enta for Loic Lapoussin
46mins: Ghana comot Iddrisu Baba and bring in Majeed Ashimeru
Ghana 0-0 Madagascar
57mins: DISSALLOWED GOAL! Ref catch Inaki Williams for offside again afta a good tap in to di net
55mins: Di Black Stars dey create more chances but dem neva fit convert am
53mins: YELLOW CARD! Razafindraibeharimihanta Nirina na di first player to chop card for di game
51mins: Good save by Adrien Melvin of Madagascar
49mins: Ghana start di second half wit intensity and pressure. Dem dey try to find di back of di net
47mins: Good cross from Semenyo into di 18 yard box for Inaki Williams wey drop di ball for Ayew. Missed chance
Ghana 0-0 Madagascar
45mins: SUBSTITUTION! Zlidu Seidu comot for Dennis Odoi
First Half
Ghana 0-0 Madagascar
45+2mins: HALF TIME
45mins: OFFSIDE! Ref catch Inaki Williams offside
43mins: Ghana dey try build from di back. Madagascar no dey allow dem
41mins: Richard Ofori make anoda good save for Ghana
Ghana 0-0 Madagascar
38mins: Ayew try to find Inaki Williams but di pass too much
37mins: Di Black Stars never fit connect complete pass toogeda
35mins: Madagascar dey try slow down di pace of di game sake of pressure from di Black Stars
31mins: Ghana defence dey slack seriously
29mins: Good save by Ghana goalkeeper Richard Ofori
27mins: Corner kick for Madagascar
23mins: Madagascar don start to collapse. Dem don dey lose concentration
17mins: Ghana don start to react
15mins: Ghana dey struggle to come out wit di ball
Ghana 0-0 Madagascar
10mins: Ghana no fit get di ball. Dem dey get complications
5mins: Madagascar start wit dominance
1min: KICK OFF
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Madagascar line up
23Adrien Melvin, 21Thomas Fontaine, 5Razafindraibeharimihanta Nirina, 12Kenji-Van Boto, 20Romain Métanire, 17Loic Lapoussin, 7Rayan Raveloson, 6Marco Ilaimaharitra, 13Tokinantenaina Randriatsiferana, 22Dorian Bertrand, 10Njiva Rakotoharimalala











