Kogi state govnorship election result as Inec declare am

Di three main canidates for Kogi election

Wia dis foto come from, Ododo/Melaye/Ajaka/Facebook

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don announce APC Ahmed Usman Ododo winner of Kogi state govnorship election.

Ododo win with 446,237 votes while im closest rival Murtala Ajaka wey dey represent di Social Democratic Party (SDP) poll 259, 052 and Dino Melaye of di Peoples Democratic Party, PDP get 46,362.

Kogi state get 21 local goment areas.

Di Deputy Vice-Chancellor of di University of Nigeria, Nsukka, Enugu state Professor Johnson Urama na im be di state returning officer for di Independent National Electoral Commission (Inec) na im announce di results from di local goment areas.

Di pipo of Kogi state vote who go lead dem for di next four years on Saturday.

Na 18 candidates and political parties contest di govnorship election for wey happun on 11 November 2023.

And na for all of di 21 local goment areas of Bayelsa state di election happun.

Di main candidates for di election na na Senator Dino Melaye of di PDP, Ahmed Usman-Ododo of APC and Murtala Ajaka wey dey represent di Social Democratic Party (SDP).

For governorship election, di candidate wit di highest number of votes cast na im dem go declare winner – na di Returning officer of Inec go make di declaration.

According to di Electoral Act, di candidate must also get more dan one-quarter of di votes cast in at least two-third of each local goment area of di state.

Move around di map to see di results local goment by local goment as Inec declare am