Election don ova, Una bye bye!
Na here we go gbab break for our coverage of 2023 off-cycle election.
And wit di announcement of di winner of di Bayelsa State election, dis off-cycle election season don finish.
Di election bin give new govnor to Kogi state and renew di govnorship for second term to Imo and Bayelsa State govnors.
But di belief be say no be evri election go smooth like dat and now di parties wey dey vex on top di mata go get seven days to open dia case in front of election tribunal.
We thank una for staying wit us for BBC News Pidgin throughout di entire process.
We go see una again next year 2024 for di Ondo and Edo state governorship elections







