Nigerian Pastor Chris Okafor apologise to actress Doris Ogala wey accuse am, kneel bifor congregation

A man holding microphone

Wia dis foto come from, @chrisokaforministries/Instagram

Read am in 4 mins

Afta di kasala wey burst for social media between Nigerian actress Doris Ogala and di senior pastor of di Mountain of Liberation and Miracles Ministries, Chris Okafor, di man of God don publicly apologise to di lady and oda pipo wey im offend.

Inside one video wey don go viral on social media, Pastor Okafor kneel bifor im congregation as e seek forgiveness for di mistakes wey e don make for past.

Ogala bin accuse Pastor Okafor of affair and say e break di promise say im go marry am. She also claim say di man of God give am $10,000 to swallow her claims against am and to tell pipo say na oda pastors hire am to defame am.

"Di lady wey dem dey call Doris Ogala, listen, we no dey join issues. Mistakes don happun for di past, and I tender apology to evribodi," Pastor Okafor tok, and add say no be evritin wey Ogala tok be true.

"Many lies dey for most of di tins wey dey spoken. But even though, I say I dey sorry to evrione wey I don offend, to di Doris Ogala I also say sorry, and I apologise to evrione wey I don offend."

Pastor Okafor say im no dey perfect and say im readi to make restitution to anyone wey e don offend.

"Anybodi, anylady anywia wey I don offend, I dey sorry, forgive me. I no dey perfect, I no eva dey perfect. But I tell you, I don get new beginning since di coming of dis fathers of faith into my life," e tok.

"I dey kneel down bifor evrione and bifor di church. Forgive me. You fit judge me, pray for me."

For her Facebook page, Ogala say she forgive Pastor Okafor but say she get problem wit di claim of lying wey di pastor make during di apology.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Brief background of wetin happun

Doris Ogala bin accuse Pastor Okafor say e fail to marry am afta e promise am marriage. She claim say she and di pastor date for several years from 2017.

She also say Pastor Okafor contribute to di breakdown of her previous relationship.

Di actress allege say she bin end her previous marriage becos di pastor ask am to and she suffer emotional distress wen di relationship bin dey suddenly terminated.

Pastor Okafor no directly address all dis claims during im public apology but e say no be evritin Ogala tok be true.

Despite di gbas-gbos wey bin go on for social media, Pastor Okafor proceed wit im wedding wit im fiancée wey happun dis month.

Who be Pastor Chris Okafor?

Dem born Chris Okafor on April 4, 1970 for Benin City, Nigeria.

E be Christian minister and televangelist. E be di leader and founder of Mountain Of Liberation and Miracle Ministries, wey also dey known as Liberation City.

Pastor Okafor also get one non-govmental organisation, Chris Okafor Humanity Foundation, wia e take dey empower underprivileged pipo wit skills.

Di senior pastor dey widely travelled and known across Africa and beyond by di vehicle of im mandate, Chris Okafor World Outreach Ministry (Cowom), wey don take message of liberation to countless homes in crusades and via di Liberation TV, e tok for one of im books.

Who be Doris Ogala?

Doris Ogala na Nigerian actress. Dem born her for Ndiagwu, Amokwe Item for Abia State, southeast Nigeria.

She start her acting journey for di early 2000s and gain prominence within Nollywood.

She enta public eye recently afta she accuse di Pastor Chris Okafor of breaking her heart afta e promise to marry her.