You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wen be Harris vs Trump ogbonge presidential debate? Evritin to know
- Author, Jeremy Howell
- Role, BBC World Service
- Read am in 7 mins
Di second of di US presidential debates go take place on Tuesday night and dis go be di first time wey Donald Trump and Kamala Harris go face each oda.
Di presidential debates dey widely watched on television and e fit get big influence on how Americans go decide to vote.
Di Republican ex-president and di Democratic vice-president dey locked for tight race, both nationally and for di swing states.
Kamala Harris get record as better debater wey sabi, but Donald Trump also show for di 2016 and 2020 presidential debates say im be big rival.
Wen be di presidential debate and wetin be di rules?
Di debate go take place for Philadelphia on 10 September. E go start by 9 pm, Eastern Time.
Dis na di second presidential debate of 2024. Di first bin hold for June between Donald Trump and President Joe Biden, bifor e decide to drop out of di race.
Di debate go dey live for ABC and ABC News Live go stream am.
Di event go last 90 minutes wit two commercial breaks, and audience no go dey di room.
BBC News channel and BBC News website go stream am live, e go also dey live on di app via dia live page.
BBC go get team of reporters for Philadelphia and for Washington wey go dey provide analysis, fact checks and reactions as part of dia live coverage.
E get strict time limits. Each candidate get a maximum of two minutes to ansa questions from di moderators and go get two minutes to counter dia opponents.
Di candidates microphones go dey muted wen di oda pesin dey speak, and audience no go dey di debating room.
Ms Harris bin want make di microphones dey live throughout but recently she bin agree to di rule.
E dey introduced four years ago afta di first debate between Mr Trump and Mr Biden face interruptions and quarrels.
Tuesday debate go dey run by two moderators, David Muir and Linsey Davis, both of dem dey present news programmes on ABC.
Wetin to look out for?
As e show for di fallout from Oga Biden stumbling debate performance wey make am end im candidacy, presidential debates na high-stakes campaign milestones wey fit reshape di race.
Na unique chance for candidates to impress voters as di clips go go viral and di soundbites go dey replayed ova and ova.
Dis go dey very important for Kamala Harris, wey for her campaign appearances so far don follow di script.
New polling by Siena College for di New York Times, wey dem publish on Sunday, suggest say many voters neva still know who she be and wetin she stand for.
Di race between her and Trump remain extremely close, both nationally and for di swing states wey go decide di outcome.
How di candidates dey prepare?
Ms Harris dey prepare by working wit Washington lawyer Karen Dunn, according to di New York Times, wey say Dunn don help Democratic politicians plan for debates for nearly two decades.
Dunn, wey dey often represent tech companies for court, dey operate wit "tough love", 2016 Democratic nominee Hillary Clinton tell di newspaper.
"She no dey fear to say, ‘Dat no go work’... But she also dey offer encouragement," Clinton tok.
Philippe Reines, one former Clinton adviser wey bin stand for Trump during her mock debates, reportedly dey repeat di role for Ms Harris.
Trump, on di oda hand, no dey follow di classic debate preparation tactics, according to US media.
Notable advisers to di former president for di lead-up to dis debate na Tulsi Gabbard, one former Democratic congresswoman wey bin clash wit Ms Harris during di party 2020 primary debates, and Florida Republican congressman Matt Gaetz.
Wetin be Kamala Harris strengths as a debater?
Kamala Harris don participate for election debates eva since 2003, wen she bin win di race to be San Francisco district attorney.
She also take part for debates during her successful campaigns to dey elected as California attorney-general and as a US senator for California.
She debate wit Joe Biden for 2019 wen she run for di Democrat presidential nomination, and she face off against Mike Pence for di 2020 vice-presidential debate.
She don show say she fit take control of di stage. For di 2020 debate wit Mr Pence she vex for am say e interrupt her, saying: “Mr Vice-President, I dey speak.”
Ms Harris don gain a lot of debating experience for di US Senate and bifor dat as prosecutor for California courts, wia one key skill na to highlight weaknesses for di opponent case.
Dis fit benefit her wen she dey counter points wey Donald Trump make for di debate.
Howeva, Ms Harris bin fail for her bid to become 2020 Democratic presidential candidate as she drop out bifor di first contest for Iowa, and one criticism na say she no get consistent policy positions.
For Tuesday debate, Ms Harris dey likely to ansa several hard questions about her policies from di moderators.
Ms Harris also dey loud for her public speaking.
For example, for her recent CNN interview she say: “Na urgent matter to dey apply metrics wey include to hold oursefs to deadlines around time.”
For presidential debates, speaking time dey limited and campaign messages gatz come clearly to voters.
Wetin be Trump skills as a debater?
Tuesday debate against Mr Trump go be di greatest challenge Ms Harris don get to face since she enta di race.
E don take part for two sets of presidential debates, for 2016 and 2020, and prove to be a very confronting and old style opponent.
For di 2016 debates against Hillary Clinton, e waka around di stage and stand directly behind her while she dey speak, wey she say e “make her flesh creep”.
For di first of di presidential debates for 2020 e dey always interrupt Joe Biden, wey make am shout: “Will you shut up, man?”
Dis tactics bin stop im opponents and keep am as di centre of attention.
Howeva, Mr Trump dey sometimes tok off topic for debates and e make statements wey dey untrue according to fact-checkers.
Which candidate dey lead for di polls?
Bifor e stand down for re-election as president last July, Joe Biden bin dey behind Donald Trump for polls of voters, both nationally and for several swing states.
RealClearPolitics, one political analysis organisation wey compile an average of national polls, say Ms Harris don become more popular dan Trump since she become di Democrat nominee.
E say she dey lead Trump by 1.9 points nationally, as of 3 September.
Howeva, Hillary Clinton get a lead of five points for di national polls for di same poll for 2016 and still lose di election to Mr Trump.
Polls within di states dey seen as more important dan di national polls. Dis na becos election results for individual states dey determine di number of votes candidate fit gain for di electoral college, and di electoral dey college decide who go become president.
E get some swing states such as Arizona, Georgia, Michigan, North Carolina and Pennsylvania wey dey imporant for candidates to win.
For all of dis, di race dey veri tight.
For early September, RealClearPolitics say Harris bin manage to overtake Trump for di polls for Michigan and Georgia and e dey tied wit him for Pennsylvania, but still dey follow for Arizona and North Carolina.
Di agreement among political analysts na say di outcome of di election dey difficult to determine.
One candidate need 270 electoral college vote to win di presidency. Di polls currently suggest di Democrats dey assured of 226 electoral college votes, di Republicans dey assured of 219, and di remaining 93 fit go any way.
More debates go dey?
On 1 October, rival running mates JD Vance and Tim Walz go participate for one single vice-presidential debate on CBS News.
But di presidential campaigns neva agree on di terms for any future showdowns between Trump and Ms Harris.
Trump don call for at least two more. E dey push in particular for a showdown on more friendly turf - wey Fox News go moderate and wey go get large live audience.
Harris campaign say dem go evaluate weda dem go do or dem no go do a second debate for October, once dem conclude dia first face-off.
Dem don sideline one non-partisan Commission on Presidential Debates (CPD) wey don oversee dis events since 1988 in favour of di TV networks wey dey deal directly wit di campaigns.
Di CPD, wey bin intend to organise three debates for September and October, bin blame di Biden campaign say dem fail to abide by tradition.