Five takeaways from day three of Democratic National Convention ahead of US presidential poll

Read am in 6 mins

Dem formally nominate Tim Walz as di Democratic candidate for vice-president at di party convention for Chicago on Wednesday night - wia delegates also delight in a surprise speech about freedom from Oprah Winfrey.

Minnesota Democrats na di last to leave di United Centre afta dia state govnor ginger di room wit a folksy "pep tok" wey dey inspired by im love of American football. Im proud son Gus bin dey veri emotional im even cry.

Di night also play host to Democratic grandees like former President Bill Clinton and former House Speaker Nancy Pelosi, as well as rising party stars including Josh Shapiro, di govnor of di key swing state of Pennsylvania.

In case you miss di convention third night, dis na some of di highlights.

'Coach Walz' folksy style

Govnor Walz give a brief speech to formally accept im nomination as im party vice-presidential candidate - and tap into im favourite sport.

"I neva give a lot of big speeches like dis bifor, but I don give a lot of pep toks," im tell di cheering crowd.

Di former high-school American football coach go on to use pitchside toks to try ginger di Democrats and moderates alike.

Im portray im side as di underdogs for di presidential match: "Na di fourth quarter, we dey down a field goal, but we dey wan attack and we get di ball. We dey drive down di field, and … we get di right team."

Members of Oga Walz old team bring di metaphor to life as dem wear dia old jerseys and rush to join am on stage, all dis dey happun as horns and drums of marching band bin dey play for background.

Oga Walz yarn na folksy pitch to middle America. Im also tok about im experience as a teacher, im lifelong love of hunting and im family fertility struggles.

Im rely on phrases wey don become hits wit Democratic devotees. One of dem na - "wen we fight, we win" - pipo for di room shout am like sports crowd.

'Dat na my dad': Gus Walz cry

Wednesday night see anoda family affair for DNC - wit scenes wey be like di appearance by Donald Trump and JD Vance wit dia wives and relatives for di Republican gathering last month.

Oga Walz describe im wife Gwen and children Hope and Gus as im "entire world" – dat word make Gus stand up, shout wit tears say: "Dat na my dad."

Ahead of di convention, Oga Walz and im wife bin speak to People magazine about dia "brilliant" 17-year-old son, say im bin get learning disorder, ADHD (attention deficit hyperactivity disorder) and an anxiety disorder - dem add say dis conditions give am "super power".

Madam Harris family also get prominent role. Tony West, her brother-in-law, speak about how dem meet for law school, and how Madam Harris don go on to fight for her family - im add say she go do dis for voters if dem elect her as president.

Na dis same message Harris niece and two nephews - Alexander Hudlin, Jasper Empoff and Arden Emhoff share, wey appear on stage to say "auntie" go be president for "all of us".

Hudlin say Madam Harris calm im fears as a nine-year-old wen Trump bin win presidency for 2016. She tell am say: "You know wetin superheroes dey do? Dem dey fight back."

Oprah stand up for 'childless cat ladies'

Di crowd scata wen media mogul Oprah Winfrey step up in front of di DNC podium, to make a surprise appearance wit purple pantsuit outfit.

Invoking di words of civil rights leader John Lewis and di lyrics of Woody Guthrie This Land is Your Land, di long-time TV host tell di audience say "America na ongoing project" wey require "hard work and heart work".

Winfrey tok about abortion bans for Republican states as example of loss of freedom. "If you no fit control wen and how you choose to bring your children into dis world and how to raise and support dem, den e mean, no American dream."

As she dey tok about di principles of unity and neighbourly values, she use parable of a house on fire - say di right tin to do na to save pipo wey dey live inside, even if one of dem na "childless cat lady".

Dat comments refer to one 2021 interview wey Oga Vance call Democratic politicians as “a bunch of childless cat ladies".

She no be di only celebrity wey show support to di Democratic cause on Wednesday.

Soul legend Stevie Wonder climb podium – to play piano wit John Legend wey sing Prince song Let's Go Crazy.

E also get some moments wey no get anytin to do wit politics like Comedian Mindy Kaling wey make joke about Ben Affleck divorce from Jennifer Lopez.

Clinton warn against overconfidence

Former President Bill Clinton deliver im 12th straight convention speech – a tradition wey go back as far as 1980 and span di period wey im win two White House terms for 1990s.

Im receive warm welcome from di Democratic faithful, even if e no dey di same level as former president, Barack Obama, on Tuesday night.

"For 2024, we get a clear choice: 'We di Pipo' versus 'Me, myself, and I,’" di 78-year-old tok, referring to Trump. "I know di one I like pass for our kontri.”

Clinton, wey dem born for small Arkansas town of Hope and later become dat state govnor, tok about di warning wey di Obamas give last night - say make Democrats no dey “overconfident”.

"One of di reasons wey President-to-be Harris dey do so well na say we all dey so happy," im add. "But make you neva underestimate your opponent."

Pelosi tank Biden afta reports of bad blood

Former House Speaker Nancy Pelosi earn credit for helping to convince President Joe Biden to leave di 2024 White House race - as well as oda tins too.

But di crowd for di United Centre no show any bad blood. Di senior Democrat begin her speech wit gratitude for Oga Biden.

“Tank you, Joe,” di 84-year-old tok, afta she list di president legislative accomplishments.

Despite reports of bad blood between Oga Biden and Madam Pelosi, di president use im own DNC speech earlier dis week to deny say im bin dey vex wit di pipo wey call on am to step aside for dis year election.

Madam Pelosi chook mouth inside dat mata, she spend much of her remaining remarks to hail Madam Harris and she tok about Trump role for di Capitol riot on 6 January 2021.