You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'America, I give una my best': Biden tok for emotional farewell
- Author, Madeline Halpert
- Role, Reporting from Chicago
- Read am in 5 mins
US President Joe Biden address di crowd for a packed arena for Chicago on di first night of di Democratic National Convention, wia e defend im presidency – touching on many of di themes wey e campaign on for 2020 and again dis year before e abandon im re-election bid for mid-July, a few weeks after im debate performance critics say no gel.
"Like many of you, I give my heart and soul to dis nation,” e tok, towards di end of a nearly hour-long address as pipo dey shout "Thank you, Joe".
Mr Biden waka go di stage after im daughter Ashley and wife, Jill, introduce am, im wife bin tell di audience say she "see am dig deep into im soul" wen e decide to exit di presidential race.
After e hug Ashley, e use tissue to wipe di tears from im eyes.
Di president touch im heart, and stand straighter and smile as di crowd continue to cheer am.
“Selecting Kamala na di very first decision I make wen I become our nominee and na di best decision I make my whole career,” e tok. “She dey tough, she dey experienced, and she get big integrity.”
After di president conclude im remarks, Ms Harris and her husband Doug Emhoff come out to embrace Mr Biden and im wife, Jill.
“I love you,” di vice-president tell Mr Biden after dia hug.
While Mr Biden spend much of di end of im speech focusing on Ms Harris, many of di evening earlier speakers bin direct dia tributes to di current White House resident.
E start with a planned – but unannounced – appearance by Ms Harris herself, wey take di stage to big claps.
“Joe, thank you for your historic leadership and for your lifetime of service to our nation and for all you continue to do,” she tok. “We dey forever grateful to you.”
Hillary Clinton offer her own tribute wen she appear on stage earlier in di evening, telling di crowd say Mr Biden bin "bring dignity, decency and competence back to di White House".
Di 2016 Democratic nominee receive long ovation, and she note say while she no break di “highest, hardest glass ceiling” by becoming di first woman president, “on di oda side of dat glass ceiling na Kamala Harris taking di oath of office”.
With just three months to go before di 2024 election, thousands go gather for Chicago dis week for di Democratic National Convention.
Na tradition wey go back to di 1830s, wen a group of Democratic delegates wey support President Andrew Jackson bin gather for Baltimore to nominate am for a second term.
Dis year go look slightly different from odas, as di Democratic Party don already officially nominate Vice-President Kamala Harris for one virtual roll call after President Joe Biden drop out of di race.
But many of di oda DNC traditions - including appearances from celebrities and memorable speeches from party leaders - go remain di same. Dis na wetin you need to know.
When and where be the DNC?
Dis year convention dey happun for di United Center Arena for Chicago from Monday 19 August to Thursday 22 August.
Wetin dey happen for the DNC?
Because Ms Harris and Mr Walz don already dey nominated, dis year convention go focus on speeches from prominent Democrats and di adoption of di party platform.
Delegates dey work during di day to finalise di platform, draft wey don already dey released.
E focus on issues, including plans to lower inflation, mitigate climate change and tackle gun violence. For di draft, Democrats highlight di party positions with Project 2025, wey be a super conservative blueprint for wetin a second Trump administration fit look like, wey Heritage Foundation be di author. Trump try to distance imself from di project, though several of im padi-padi dem bin dey involved in di writing.
Who go speak?
Plenti prominent Democrats and celebrities go take di stage for Chicago.
President Biden bin headline di convention on Monday night. Di crowd bin also hear from First Lady Jill Biden, and oda Democratic leaders.
On Tuesday, former President Barack Obama dey expected to deliver remarks. Illinois Governor JB Pritzker and Ms Harris’s husband, Second Gentleman Doug Emhoff, go also address di convention on Tuesday.
Wednesday line-up according to reports feature former President Bill Clinton and former Speaker of di House Nancy Pelosi, among odas.
Ms Harris running mate, Minnesota Governor Tim Walz, go give di prime-time speech dat night after im nomination.
Di most important night of di convention na Thursday, wen Vice-President Harris go take di stage. She go formally accept di presidential nomination and give her speech on di final night of di convention dedicated "For the Future."
Former Secretary of State Hillary Clinton, former First Lady Michelle Obama, Senate Majority Leader Chuck Schumer and House Minority Leader Hakeem Jeffries go also take di stage at some point during di week.
Famous politicians no be di only ones wey go make appearance. Di convention go also hear from several everyday Americans, including Trump voters.
Who else go dey in attendance?
Around 50,000 pipo dey expected to attend dis year convention for Chicago. E include thousands of delegates wey di state Democratic parties choose as well as super delegates, wey majorly be elected officials, notable members of di Democratic Party and some members of di Democratic National Committee.
Thousands of members of di media go also attend.
E go be a star-studded convention with appearances from several celebrities. For 2020, actors Julia Louis-Dreyfus and Eva Longoria attend di convention, while Elizabeth Banks and America Ferrera attend for 2016.
Rumours dey go round whether mega-stars Beyoncé and Taylor Swift go attend dis year, but dem never actually confam say dem go dey dia.
Protests go happun?
Demonstrations dey planned for outside di DNC venue, many of wey dey centred around opposition to US support of Israel war for Gaza. Organisers don say as many as 10,000 pipo fit come to march. Protesters don dey fight with di city of Chicago about wia dem fit demonstrate.
How the public fit watch?
Members of di public fit only attend di convention in person by becoming volunteers.
Major TV networks go provide coverage of di speeches and events, as well as C-SPAN.
Additionally, for di first time ever, di convention get plans to offer vertical streams of the events for TikTok, Instagram and YouTube, so viewers fit watch for their phones.
You fit follow di latest news, including daily live pages and analysis from BBC teams for di Democratic convention, for bbc.com/news.