Wafcon 2024: Some first-timers wey fit help Nigeria Super Falcons sustain dia legacy

    • Author, Tamara Ebiwei
    • Role, BBC Pidgin
  • Read am in 6 mins

Na few hours remain for di 2024 Women's Africa Cup of Nations [Wafcon] to start. Di opening ceremony go happun for di Olympic Stadium for Rabat.

Di opening match na host Morocco vs Zambia.

But for di Super Falcons of Nigeria, na less dan one day to dia opening match.

Di Super Falcons na one of di strongest sides for dis tournament. In fact, dem be di most decorated sake of say dem bin don win di trophy nine times. Now dem dey compete to win dia 10th title.

No women's team for Africa don come near dis achievement, na why Head Coach of di team Justin Madugu tell Nigerians say dem dey do evritin to make sure say di team maintain di confidence wey dem get ova di years.

"We dey do evritin on our part to make sure say we sustain di confidence wey Nigerians don give us, we go try as much as possible to meet una expectations, make una kontinu to trust and support di team."

Join Pidgin WhatsApp Channel for more tori on Wafcon 2024.

Coach Justin Madugu take ova from American Coach Randy Waldrum wey bin dey lead di team from 2020 till September 2024.

As Madugu don come now, im fit help Super Falcons overcome dia shortcomings?

Wetin be di shortcomings of di Super Falcons?

Some pipo go still ask wetin be di shortcomings of a team wey dey always represent for women's football for Africa and nobody don beat dia record till now.

Di answer be say even though dis team dey shine well-well according to history, dem neva too perform well in recent years.

Di last time wey dem win dis Wafcon trophy na six years ago, 2018 wen dem beat South Africa [4-3] on penalties for Accra Ghana.

Wen former Coach Randy Waldrum bin take over for 2020, expectations bin no too high sake of say di man na University student coach and im bin dey do di Super Falcons job side by side wit im oda work.

Randy Waldrum bin no to dey steady wit di team and some women's football pundits bin tok say na one of dis distractions wey di team bin get.

Randy Waldrum manage carry dem finish fourth for di 2022 edition, na Zambia beat dem 1-0 for di third place match for Morocco.

Now wey Justin Madugu don take charge of di team, Nigerians believe say im go do well.

Nigeria dey Group B wit Tunisia, Algeria, Botswana, Nigerians believe say di kontri go qualify from dis group.

Some oda pipo dey argue say host kontri Morocco fit win sake of di way dia women football dey grow and di kain players wey dem get.

See di complete Wafcon 2024 squad and di ogbonge players wey dey dis tournament.

Who be di first timers and wetin dem fit do

Di Nigeria squad list for di 2024 Wafcon get a combination of both old and young players.

And on Friday, di players get dia official jersey numbers for di tournament.

Some of di Wafcon first-timers na homebased players from di Nigeria Women Premier League [NWPL].

Miracle Usani - She be defender wit Edo Queens. For 2022 she bin win bronze medal for di U17 Women's World Cup.

Di Confederation of African Football [Caf] bin also name her for di Women's Champions League Best XI [Eleven]

She win di West Africa Football Union [Wafu B] Women Champions League qualifier last season for Ivory Coast.

Miracle wey dey 18 years na one of di most promising defensive talents for Nigeria.

Dem fit add value to di team and dem go try to show say dem no come dis tournament to play, some of dem na:

Racheal Onachukwu - Na Goalkeeper wey dey play for Nasarawa Amazons. She be dia number one goalkeeper.

Racheal join di club for di 2022/2023 league season from Edo Queens of Benin, south-south, Nigeria.

Di way she dey perform for di club during for di domestic league wit Nasarawa Amazons fit don contribute to why dem select her for di Super Falcons squad.

Role in the Team:

Football sabi pipo tok say her skills and experience go dey important for di team as dem dey try to succeed for di tournament.

Sikiratu Isah of Nasarawa Amazons too go play her first Wafcon. She be beta defender wit good tactical defensive skills.

She be ogbonge player for both Nasarawa Amazons FC and di Super Falcons. Here E don tey wey she join Nasarawa Amazons and she dey play well until coach Justin Madugu see her performance for di Betty Obaseki tournament.

Dem no dey joke wit her tactical defensive skills wey be valuable assets to her club an kontri.

Media Officer of Nasarawa Amazons, Adakwuochoche Emmanuel tell BBC Pidgin say " her inclusion for di Super Falcons squad show her hard work and dedication to di sport. Her performance for dis tournament go dey imporant for Nigeria success."

Oda players to watch na Shikurat Oladipo wey from FC Robo Queens for Nigeria move to AS Roma Ladies.

Experienced hands

Di Wafcon team get plenti players wey don win di title bifor, dis players don play for di higest level of international footballl.

Di likes of Francesca Ordega wey dey currently play for Ittihad Ladies Club, Saudi Arabia.

Osinachi Ohale don dey play for di national team for ova 10 years, she bin start wit U – 20 for 2010.

She be part of di team wey bin win in di title 4 times back to back.

Tochukwu Oluehi na di former number one goalkeeper for Super Falcon bifor Chiamaka take ova. Di former Rivers Angels goalkeeper still dey play professional football. She aslo get Wafcon titles to her name.

Asisat Oshoala na di most decorated Women's Footballer for Africa. She don win multiple Wafcon titles and also Caf Women's Player of di Year a record six times.

Di question na if di experience wey dis players get go pay-off dis time.

Na only time go tell if dia experiences fit help Nigeria win dia 10th title.