'E no make sense' - Ronaldo, odas pay tribute to Liverpool star Diogo Jota wey die for car crash

Read am in 5 mins

Tributes don pour in from around di world for di Liverpool star Diogo Jota wey die at di age of 28 years.

Di Portuguese winger involve for one car accident for Zamora, Spain.

Local media Marca report say di accident occur for A52 road, near di municipality of Palacios de Sanabria.

Jota dey inside motor wit im broda Andre wen dia car clear comot from road.

Diogo Jota broda wey be 26 years old, na professional footballer too, wey dey play for Portuguese second-tier club Penafiel.

Guardia Civil tell BBC Sport say Jota and im broda die around 00:30 local time on Thursday.

Dem tok say dia car, Lamborghini, comot for road becos tyre burst as dem dey overtake anoda motor, and di car catch fire.

Jota marry im long-time partner Rute Cardoso, wey dem don get three children togeda, just last month.

E recently post pictures for social media, from di ceremony wey happun on 22 June.

Jota help Liverpool win Premier League title last season and e play for Portugal as dem beat Spain for di final of Nations League for June.

"Portuguese Football Federation (FPT) and all of Portuguese football dey completely devastated" Pedro Proenca, head of FPT tok.

"More dan just bin amazing player, wit almost 50 international appearances, Diogo Jota na extraordinary person, wey all team-mates and opponents respect, person wey get infectious joy and na reference for di community."

Tributes from all ova di world for Diogo Jota

Tributes don dey pour in from across di world for Liverpool forward Diogo Jota and im brother, André Silva, wey die for one car accident for Spain.

Thousands of football fans gada for Anfield stadium to pay dia respects to di football star.

Plenty flowers, football shirts, scarves, balloons and flags full outside Liverpool ground since di tori of im death break.

UK Prime Minister Sir Keir Starmer don offer condolences to Diogo Jota friends and family. E say im thoughts dey wit Jota friends and family.

Di Prince and Princess of Wales don also pay tribute to Jota family and friends. For one statement on X, di couple say, "As part of di footballing family, I dey very sad to hear of di passing of Diogo Jota and im brother."

Di royals add say dia thoughts dey wit Jota family, friends and all di pipo wey sabi am for Liverpool FC and Wolves – di two clubs for England wey Jota bin play for.

Liverpool, im club say dem dey "devastated" by di "unimaginable loss" of forward Diogo Jota, wey die for car accident at di age of 28.

Di club add say: "Liverpool FC no go make any further comment at dis time and request say make di privacy of Diogo and Andre family, friends, team-mates and club staff dey respected as dem try to come to terms wit di unimaginable loss."

Portugal captain Cristiano Ronaldo, wey play alongside Jota, bin post on social media say: "E no make sense. Just now we bin dey togeda for di national team, you just marry."

Jurgen Klopp, di former Liverpool manager wey sign Jota for di Reds, say im dey "heartbroken".

"Dis na moment wia I struggle. Bigger purpose must dey for dis. But I no fit see am," di German coach post on Instagram.

Portuguese football club Porto tok say na wit "shock and deep sorrow we extend our heartfelt condolences to di family and friends of Diogo Jota and im brother André Silva, wey also be our athlete for di youth ranks," di club write for post on social media.

Manchester City: "Everyone at Manchester City dey shocked and sad to hear about di devastating news regarding di passing of Diogo Jota. We send our heartfelt condolences to im family and friends and everyone at Liverpool Football Club at dis difficult time. Rest in peace, Diogo."

Manchester United: "Our deepest condolences dey wit di loved ones of Diogo Jota and im brother, Andre, and everyone connected wit Liverpool FC following today heartbreaking news."

Everton: "Everyone at Everton dey deeply sad by di tragic passing of Diogo Jota and im brother André Silva. Our thoughts dey wit dia family and friends at dis sad time."

Di Football Association (FA) and di Premier League say dem dey "devastated" to hear of di deaths of Diogo Jota and im brother André.

Both send dia deepest condolences to Diogo family, friends and team-mates for one post for social media.

"Football don lose a champion who we go miss forever," Premier League add.

"Di tori of Diogo Jota, ogbonge athlete wey greatly honour Portugal name, and im brother dey unexpected and tragic," Portuguese Prime Minister Luís Montenegro tok.

Di prime minister send im "deepest condolences" and add say, "Na sad day for football and for national and international sport," e tok.

Diogo Jota profile

Dem born Diogo Jota for 4th December 1996. E be Portuguese professional footballer wey play as forward or left winger for Premier League club Liverpool and Portugal national team. Jota sabi score well, e get speed and e sabi dribble.

Jota start im career wit Paços de Ferreira, before e sign for La Liga club Atlético Madrid for 2016.

Afta two seasons for Primeira Liga, dem loan am go Primeira Liga club FC Porto for 2016 and EFL Championship club Wolverhampton Wanderers for 2017.

E help dem promote to Premier League, and e join di club for 2017 for €14 million. E play 131 matches for dem, score 44 goals. For 2020, e sign for Liverpool for £41 million.

E make im senior international debut for November 2019.

Diogo Jota don win four trophies wit Liverpool: one Premier League title, one FA Cup, one League Cup, and one UEFA Nations League title.

E win Premier League for 2024-2025 season. E win FA Cup and League Cup for 2022. E also follow Portugal team win UEFA Nations League for 2019 and 2025.

Jota die for car accident for Zamora, Spain, on 3 July 2025.