Transfer news: Luis Diaz, Nico Williams, Rashford and oda deals wey dey happun for transfer window

Read am in 8 mins

Teams for Europe and oda continents don begin dey sign players during dis window to improve dia squad for di upcoming season.

Di contract of some players end for 30 June 2025, wey mean say dem become free agent to move to oda clubs.

Some teams especially for England dey wrap up dia deals quick quick while odas for Spain and Italy still dey pursue dia targets gidigba.

Liverpool defender Jarrel Quansah join Bayer Leverkusen

Jarrel Quansah bin sign five-year contract wit di German club for deal wey dey around £35m.

Bayer director of sports oga Simon Rolfes tok say "Quansah na one of di most promising English central defenders."

Im go wear di number 4 jersey for Leverkusen.

Liverpool sign midfielder Florian Wirtz from Bayer Leverkusen for £116m three weeks ago.

Liverpool reject Bayern Munich offer for Luis Diaz

Liverpool don bounce Bayern Munich afta dem make formal move to sign Colombia forward Luis Diaz

Bayern director of sports oga Max Ebrel say dem tok am say di premier league club no get intention to sell di player.

Liverpool no wan sell di player wia score 22 goals for club and kontri last season.

Diaz bin tok say "I dey happy for Liverpool. Di transfer market open wey we don dey try to arrange wetin be best for us. I dey wait to see wetin go happun."

Im add say "if Liverpool give us good extension or I gat to finish di two years on top my contract, I go dey happy. Everitin now dey depend on dem."

Chelsea almost complete Joao Pedro signing

Chelsea try to wrap up di signing of Brazilian striker Joao Pedro from Brighton.

Di 23-year old don reportedly do medical for di US wia im go join di Chelsea squad to prepare for di quarterfinal match for di club World Cup against Palmeiras.

Di blues day ready to seal di £60m deal via go make di Brazilian sigh longterm contract until 2032.

Club coach Enzo Maresca bin dey consider to use Joao Pedro at some point for di club World Cup afta Nicolas Jackson bin chop red card for one of die group games for di competition.

Transfer guru Fabio Ramano bin tok say "Chelsea fit finalise di deal on Wednesday."

Joao score 10 goals wit 7 assists last season for Brighton.

Arsenal sign goalkeeper Kepa Arrizabalaga from Chelsea

Arsenal sign di goalie on Tuesday for £5m.

Di Spain international sign 3-year deal afta im spend di last season on loan for Bournemouth

Im play 35 games. Bifor Kepa bin join Bournemouth on loan last season, im play 163 games for Chelsea wia im win di champions league, Europa league and club World Cup

Kepa also bin spend one year for Real Madrid wia im help dem to win di la liga and champions league for di 2023/24 season.

Thomas Partey Arsenal contract don end

Di Ghana midfielder im contract for di club end on 30 June, wia di club no tok anytin about renewing di deal.

Bifor coach Mikel Arteta tok say dem bin dey sit wit Partey to try and agree one deal wey go im stay for di club, but as at di time im contract don end, di club no confam any deal.

Dis mean say Partey na free agent wia fit join any team wey go want am.

Di 32-year old bin try for di Arsenal midfield last season wit 52 games across all competitions wia im make 7 goal contributions.

Partey bin join Arsenal from Atletico Madrid for 2020 wia im spend 5 seasons wit di gunners.

For di 5 season, im don win di community shield in 2023.

Arsenal dey build for dia midfield wit younger players as dem dey also finish di process to sign Spain midfielder Martin Zubemendi and Norwegian midfielder Christian Norgaard from Brentford.

According to di Arsenal insider, Turkish club Galatasaray bin dey want to sign di Ghanaian midfielder.

Tori for di media also tok say Barcelona also dey interested for di 32-year-old, just like clubs for Saudi Arabia and Serie A.

As a free agent, Thomas Partey fit join any club at anytime even afta di transfer window don close.

Semenyo sign 5-year extension wit Bournemouth

Di Ghana winger bin end all di transfer rumour as im extend im contract for di club to 2030.

Antoine Semenyo join di club from Bristol city for January 2023.

Im play 89 games wit 22 goals for di club so far wia help dem to finish ninth for di league last season.

Tori bin dey link di 25-year-old to Manchester United, Liverpool and Tottenham for di summer but dis new contract go keep am for di club until 2030.

Ansu Fati join Monaco on loan from Barcelona

Di 22-year-old Spain forward don sign new contract wey go keep am for Barcelona till June 2028, bifor im go on loan to Monaco.

Fati bin spend di last season on loan for Brighton in England wia im play 11 games wit 4 goals

Monaco gat di option to sign am for £9.4m at di end of di season.

Di French club already sign England defender Eric Dier and 2018 French World Cup winner Paul Pogba afta im complete im 4-year doping ban.

Pogba tok say im go repay di trust of di club afta im sign di deal wit tears for im face.

Ansu Fati wey bifor bifor pipo tok say na im go succeed Lionel Messi for Barcelona bin struggle to get games for di club afta im return from one long term injury.

Fati bin dey for Barcelona since di age of 16; im play 123 games for di club wit 29 goals and two league titles.

Barcelona go still complete di Nico Williams deal?

Spanish football journalist and BBC columnist Guillem Balague bin say Barcelona don agree personal terms wit Athletic Club winger Nico Williams

Williams score 31 goals for 167 games for Bilbao wia im na one of di key players for di Spanish national team.

Tori na say Nico bin gree 6-year-deal to link up wit im international team mater Lamin Yamal.

Barcelona bifor now, bin dey interested for Liverpool winger Luis Diaz but di English club say make dem carry £80m to sign di Colombian star.

Na so dem turn dia attention to Nico wia im release clause na £53m; Barca don show say dem fit activate dis clause

In fact, dia sporting director, Oga Deco bin meet wit Williams and im agents wia dem bin verbally agree.

But di club dey under strict financial wahala at dis time, wia dem gat to free space for di squad bifor dem fit to register Nico Williams.

Bayer Munich dey consider Rashford deal - gossip

Di Sun newspaper report say German champions Bayern Munich dey wan sign Marcus Rashford from Manchester United.

Di Bundesliga club dey allegedly impressed wit di 27-year-old English forward afta im loan spell for Aston Villa

If Rashford join di club, im go link up wit im international team captain Harry Kane, wia dia partnership go boost Rashford im chances for di World Cup

Earlier tori bin make rounds say Barcelona dey interested for di English player but wit dia focus on top Nico Williams, now di chance say Rashford go join di Spanish club dey slim.

But dis na football, anytin fit happun

Oda premier league deals dis summer

Aston Villa

Zepiqueno Redmond - from Feyenoord - Free

Bournemouth

Adrien Truffert - from Rennes - £11.4m (£14.4m)

Brentford

Michael Kayode - from Fiorentina - £14.8m

Caoimhin Kelleher - from Liverpool - £12.5m (£18m)

Romelle Donovan - from Birmingham City - £3m

Brighton

Charalampos Kostoulas - from Olympiakos - £29.8m (£31.5m)

Diego Coppola - from Hellas Verona - £8.5m

Burnley

Bashir Humphreys - from Chelsea - £12m (£14.7m)

Marcus Edwards - from Sporting - £8.5m

Jaidon Anthony - from Bournemouth - £7.5m

Zian Flemming - from Millwall - £7m

Max Weiss - from Karlsruher - £4.3m

Quilindschy Hartman - from Feyenoord - Undisclosed

Axel Tuanzebe - from Ipswich - Free

Chelsea

Liam Delap - from Ipswich - £30m

Estevao Willian - from Palmeiras - £29m (£48.5m)

Dario Essugo - from Sporting - £18.5

Mamadou Sarr - from Strasbourg - £12m

Crystal Palace

Walter Benitez - from PSV Eindhoven - Free

Everton

Charly Alcaraz - from Flamengo - £12.6m (£15.2m)

Leeds

Jaka Bijol - from Udinese - £15m

Lukas Nmecha - from Wolfsburg - Free

Sebastiaan Bornauw - from Wolfsburg - £5.1m

Liverpool

Florian Wirtz - from Bayer Leverkusen - £100m (£116m)

Jeremie Frimpong - from Bayer Leverkusen - £29.5m

Armin Pecsi - from Puskas Akademia - £1.5m

Milos Kerkez - from Bournemouth - £40m

Manchester City

Tijjani Reijnders - from AC Milan - £46.3m (£60m)

Rayan Ait-Nouri - from Wolves - £31m (£36.3m)

Rayan Cherki - from Lyon - £30.5m (£35.6m)

Marcus Bettinelli - from Chelsea - Nominal

Manchester United

Matheus Cunha - from Wolves - £62.5m

Newcastle

Antonio Cordero - from Malaga - Free

Sunderland

Enzo le Fee - from Roma - £19.3m

Habib Diarra - from Strasbourg - £30m

Tottenham

Mathys Tel - from Bayern Munich - £29.8m (£34.1m)

West Ham

Jean-Clair Todibo - from Nice - £36.3m

Wolves

Fer Lopez - from Celta Vigo - £19.6m (£21.3m)

Jorgen Strand Larsen - from Celta Vigo - £23m