Former Super Eagles goalkeeper Peter Rufai don die

Read am in 3 mins

Former Nigeria Super Eagles Captain and goalkeeper Peter Rufai don die.

Super Eagles don confam am. E die at di age of 61.

Reports say di legend, Dodo Mayana as dem dey popularly call am, die on Thursday 3 July morning.

Im death dey come afta di tori of di death of Liverpool forward Diogo Jota, wey die for car accident aged 28.

Reports say Rufai bin sick for some weeks, before e give up di ghost for one hospital for Lagos at about 6am on Thursday.

Super Eagles for dia post on social media hail di legendary goalkeeper say e go dey "forever in our hearts".

Di Nigeria Football Federation, NFF, wey also don confam di tori hail di legend say im "legacy live on between di sticks and beyond."

"E dey really, really shocking," NFF General Secretary, Dr Mohammed Sanusi, tok for Abuja. "Peter Rufai dead? Wetin hapun? We no even know say e bin dey sick.

"We earnestly pray to di Almighty God to grant am eternal rest, and to comfort all im loved ones as well as di entire Nigeria football family."

Peter Rufai Profile

Peter Rufai die at di age of 61.

For di peak of im career, im be Nigeria 1994 and 1998 FIFA World Cup first-choice goalkeeper.

Rufai na a giant of Nigerian football wey help di country win di 1994 AFCON tournament.

E bin dey in and out of di Nigeria senior team for 17 years.

Rufai make im debut for di den Green Eagles for one friendly match for December 1981, and e win di Africa Cup of Nations silver for 1984 and 1988, before Nigeria win di continental finals for Tunisia in 1994.

E be di country first-choice goalkeeper for three championships.

Rufai also keep for Nigeria for di 1994 and 1998 FIFA World Cup finals wia di Super Eagles make am to di Round of 16 on both occasions.

Rufai spend time after im retirement to dey discover and mentor young players.

E bin also serve as di coordinator of di Nigeria U23 team at one time.

Apart from im time wit di Super Eagles, Rufai also play for di Lagos club, Stationery Stores. E reach di final of di Africa Cup Winners Cup competition for 1981.

Rufai bin also play professionally for Belgium, Netherlands, Portugal and Spain.