Who be Greg Bovino, US Border Patrol commander and chief enforcer of Trump deportation campaign?

Gregory Bovino stand among masked men. E wear one green jacket wit emblams on di shoulders

Wia dis foto come from, Octavio Jones / AFP via Getty Images

Read am in 7 mins

US intensive care nurse Alex Pretti na di second US citizen wey go die during raids carried out by officers wey dey work for di Immigration and Customs Enforcement (Ice) agency dis month.

On 7 January, one US immigration officer bin fatally shoot 37-year-old Renee Good, also for Minneapolis, Minnesota.

Di killing of dis two US citizens don turn di focus on Border Patrol Commander Greg Bovino.

E don bicom di public face of Donald Trump mass deportation policy, wey be central promise for di president election campaign.

Bovino active presence on social media plus on di ground against protesters don also help push am bifor public eye.

Many pipo see di border control commander, wey claim say Pretti bin dey try "massacre" federal agents, as say e dey try pour petrol for di mata wey dey ground for di aftermath of di shooting.

Now, Bovino dey expected to leave Minnesota, wey fit signal a shift for di administration tone towards dia immigration crackdown.

Two pipo dey comfort each oda on 26 January 2026 for di memorial wia federal agents fatally shoot Alex Pretti. Flowers and candles dey laid out behind yellow "Police line do not cross" tape.

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock

"Turn and burn"

In recent days, Bovino don defend immigration raids for Minneapolis, one predominantly Democratic city for di northern part of di United States.

"Di victims na Border Patrol agents," e tell CNN State of di Union programme, Reuters news agency report.

Dem launch Trump crackdown for Minneapolis for December afta dem convict some Somali immigrants for one case say dem defraud di state welfare programmes.

Di state na home to di largest community of Somali immigrants for di kontri, di majority of dem na US citizens.

Ova di past year, Bovino, wey dey im mid-50s, don oversee several high-profile immigration raids, including for Los Angeles and Chicago.

E dey known for using wetin e call di "turn and burn" tactic of moving in to make quick arrests and leav quick-quick bifor protesters land.

E bin describe di tactic as: "We go turn and burn to dat next target and di next and di next and di next, and no go stop," e tell di Associated Press news agency last year.

Greg Bovina

Wia dis foto come from, Kamil Krzaczynsky/Getty Images

Controversial tactics

Bovino don provoke criticism from former govment prosecutors. Irv Miller, wey be former assistant state attorney of Cook County for Illinois, tell BBC say e believe say di border patrol chief don "violate internal policies of im agency" and di administration suppose investigate am.

Miller, wey be di legal analyst for CBS-TV for Chicago now, tok say dem suppose sack Bovino if "e turn out say e violate rules and regulations or laws for im capacity" afta dem do di investigation.

Former US Attorney for Minnesota Rachel Paulose tell BBC News say, she dey concerned say di operation dey fail to meet di purpose.

"Di focus of dis operation na rapists, murderers, child molesters, human traffickers. And so, if dose kain violent criminals continue to be di focus, make we get di word out...

"If no be wetin dey happun be dat, den we don dey lose focus."

Officers wey wear gas masks surround one man wey dem push to di ground.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Federal immigration officers detain one demonstrator during one standoff for Little Village, Chicago, Illinois, on 4 October

Initially, di Trump administration continue to voice support for di immigration raids.

Trump bin tell The Wall Street Journal on 25 January: "I no like any shooting. I no like am."

E add: "But I no like am wen pipo begin protest and e get veri powerful, fully loaded gun wit two magazines loaded up wit bullets also. Dat one too no good."

Eyewitnesses, local officials and Pretti family don challenge dat account.

Video footage show as Pretti dey feem ICE agents wit im mobile phone and dey help one woman wey di officers push, bifor dem spray two of dem wit pepper spray.

Alex Pretti dey smile as e stand between two oda pipo. E get bushy dark beard, thinning dark hair and silver glasses.

Wia dis foto come from, Dept of Veterans Affairs/Reuters

Wetin we call dis foto, US immigration agents shoot dead Alex Pretti for Minneapolis on 24 January

E be like say di administration dey change tactics to de-escalate di situation.

Trump dey send im "border tsar" Tom Homan to oversee di Minnesota operation.

Pipo consider Homan as "a more measured, politically attuned operator", North American Correspondent Anthony Zurcher write.

On Monday, White House Press Secretary Karoline Leavitt also say dem go carry out full investigation.

Border Patrol Commander Greg Bovino hold one sheet of paper wey show for di Bishop Henry Whipple Federal Building on 20 January 2026 for Minneapolis, Minnesota. Bovino mouth dey open as e dey tok. US flag dey im back and anoda flag wey carry di letters "U.S"

Wia dis foto come from, Stephen Maturen / Getty Images

Thirty-year-career

Unlike most of di federal officers dem deploy for di raids, Bovino often no dey wear mask.

Di long, olive green coat e frequently dey wear don also make am stand out and spark discussions.

Originally from North Carolina, Bovino join di Border Patrol for 1996.

Im 30-year career carry am from Washington DC go New Orleans as well as foreign postings for Honduras and Africa, according to CNN.

For 2020, dem name am Chief Patrol Agent of di El Centro Sector for southern California, CNN tok, but for 2023, dem sack am from di command of di Border Patrol sector and e dey encouraged to retire sake of one controversial social media posts, AP report.

But e return to lead immigration enforcement for Los Angeles under di Trump administration for di summer of 2025, and e don oversee raids for oda US cities.

According to one interview wit di New York Times, e consider bear hunting one of life pleasures, and e start im law enforcement working as a reserve police officer for di Blue Ridge Mountains for North Carolina.

"Pipo dey underestimate im intelligence sake of im demeanour sometimes, but e dey veri smart," Jason Owens, one former Border Patrol chief and friend of Bovino, dey quoted for di same article.

"E just get di kontri-boy demeanour, wia e dey tok about Ma and Pa America, plus im accent, and so a lot of pipo fit dismiss am. Dem dey do am at dia own peril."

One agent in green uniform wey use helmet and gas mask grab one protester wey wear jacket on 13 January 2026. Oda masked agents dey nearby.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One federal agent grab one protester during one immigration raid afta one Ice agent fatally shoot Renee Good for inside her car for Minneapolis.

Wetin be Ice?

Ice na one federal agency wey dey enforce immigration laws and conduct investigations into undocumented immigration. Dem also dey remove undocumented immigrants from di US.

Ice dey operate inside America, wit some staffing abroad. Na sister agency to US Customs and Border Protection, technically dem dey patrol di US borders, rather dan inside di kontri.

But dose roles don bicom increasingly blurred as di Trump administration don pull agents from a range of federal law enforcement agencies to participate for immigration enforcement.

Border Patrol officers increasingly dey operate within di US, dem dey part of raids wit Ice.

On 23 January - a day bifor Pretti fatal shooting - di UN Human Rights Office tok say at least 30 deaths in Ice custody dey reported last year, plus anoda six dis year.