Ghana politician Valentino Nortey face attempted homicide charge for allegedly stabbing im wife for US

the politician is alleged to have stabbed his wife multiple times over a disagreement

Wia dis foto come from, VALENTINO NII NOI NORTEY/INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Valentino currently dey Dauphin County prison dey await his hearing afta dem deny am bail
Read am in 4 mins

Anoda Ghana politician get case for di US – di third pesin in di last two weeks.

Dis time e no be corruption mata, but domestic case wit im wife.

Valentino Nii Nortey wey contest di 2024 parliamentary elections for Ghana, dey di Dauphin County prison.

E dey face charges of attempted homicide, possession of instrument of crime and tampering wit evidence afta im allegedly stab his wife for Pennsylvania.

Lower Paxton police say di victim dey stable condition afta she undergo surgery.

"We get report from Dauphin County about one stabbing incident – di victim arrive for di local hospital wey she undergo emergency surgery," di Lower Paxton Police Bureau tok.

Di statement add say "di victim currently dey stable wey she dey recover."

Lower Paxton police bureau identify di suspect as Valentino Nortey wey dem "pursue am without any drama wey we carry am go di Dauphin County booking centre."

"Afta arraignment by di magisterial district judge David Judy, dem deny Valentino Nortey bail – he currently dey di Dauphin County prison wey he dey wait for his preliminary hearing," di Lower Paxton police bureau tok for dia statement.

Valentino recently graduated with a master degree in security and intelligence

Wia dis foto come from, VALENTINO NII NOI NORTEY/INSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Di businessman try to enta parliament since 2016 but he neva succeed

Family of di victim dey demand justice

Family of di victim wey be di wife of di politician (Gilda Nortey) say dem want make di law deal wit dia in-law wey allegedly "attempt to kill dia daughter."

Her uncle oga David Gyapinin tok local radio station Citi FM say "dem get argument wey my niece say she go file for divorce if tins no change."

"My niece say Valentino threaten to either kill himself or kill her, wey he stab am three times."

David Gyapanin say "we believe di law go work for di US on dis mata; you no fit marry somebody's daughter wey you go try to kill her sake of she say she no go marry again. If dem no give her justice for di US when Valentino return to Ghana, we go seek justice."

As at 23 January 2026, di victim (wife of Valetino) still dey hospital.

Her uncle David Gyapanin tok BBC Pidgin say "she still dey respond to treatment for di Intensive care unit (ICU) di last time I check on her."

BBC pidgin dey try to reach di family or lawyers of di suspect Valentino Nii Nortey for reaction to all di tins wey happun, but so far e neva dey successful.

Di only message on top di social media page of di politician afta his arrest be "God dey in control."

Who be Valentino Nii Nortey

Di politician get nickname – street boy wey e dey try to enta parliament since 2015.

He contest di Klottey Korle parliamentary seat as independent candidate when im lose di primaries of his party – di new patriotic party (NPP).

He later return to his party afta he lose di 2016 elections wey he apologize to di party and dia supporters.

For di 2020 elections, he support his party new candidate Prince Appiah – but he too lose dat election to di current member of parliament for di area Dr Zanetor Agyeman-Rawlings, di daughter of ex-president Flt. Lt. Jerry Rawlings.

For di 2024 elections, Valentino Nii Noi Nortey contest again on di ticket of di NPP for di same constituency (Klottey Korle), but he lose again.

He be businessman and entrepreneur – wey he also be farmer.

Valentino Nortey get Diploma in Business Administration wey he also get Postgraduate Diploma for Professional Marketing (Level 7) from di Chartered Institute of Marketing (CIM) for di UK.

Valentino Nortey also be security and intelligent expert.

For December 2025, he graduate wit master's degree in security and Intelligence from di University for professional studies, Accra (UPSA).