Why US President Joe Biden issue 'full and unconditional' pardon for im son

Joe Biden and his son Hunter Biden hug each other

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

United States President Joe Biden don pardon im son Hunter of firearms and tax convictions despite say im bin pledge say e no go use im presidential authority to grant am clemency.

Biden issue 'full an unconditional' pardon for Hunter on Sunday and yarn say im son dey “singled out” and “selectively, and unfairly” prosecuted sake of im family name.

“Effort dey to break Hunter – wey don dey sober for five and a half years, even in di face of unrelenting attacks and selective prosecution,” Biden tok for one statement wey White House release.

“In trying to break Hunter, dem try to break me – and reason no dey to believe say e go stop here. Enough is enough.”

Explaining im decision, Biden say throughout im career, e don follow di principle of telling di public di truth out of a belief say Americans dey fair-minded.

Hunter go be di 26th pesin wey Joe Biden go pardon for im time as president according to BBC American partner CBS.

Reacting to di news, Hunter Biden put out one statement wia e tok say im don "admit and take responsibility for my mistakes during di darkest days of my addiction" and add say im no go take di clemency for granted

E dey common for presidents to issue a raft of pardons in di closing months of dia presidency, however Republicans don react negatively to dis one, and brand Biden "a liar" and "corrupt".

Di youngest son of di US president bin dey found guilty of two charges wey relate to lying about im drug use for federal form and one for owning gun wen im bin dey addicted to or using drugs for June.

For September, e plead guilty to nine fraud charges for im federal tax invasion case afta e bin deny di accuse bifor say e bin dodge payment of $1.4m for income taxes from 2016 go reach 2019.

Dem suppose sentence am for 16 December.

President-elect Donald Trump don drop in own response on di mata, for Truth Social wia e write say, "Shey di pardon wey Joe give Hunter go include di J-6 hostages wey don dey imprisoned for years. Dis kain abuse and miscarriage of Justice!"

Wetin e mean by di 'J-6 hostages' na im supporters wey bin storm di US Capitol on 6 January 2021 to try overturn Trump defeat for di 2020 election.

But na still Trump wan appoint man wey im pardon for 2020 as ambassador.

BBC US Digital tori pesin, Mike Welding tok say, "no take Donald Trump criticism of Joe Biden pardon like say na condemnation of all favours wey concern family members. "

Just one day ago, Trump tok say im wan nominate Charles Kushner as ambassador to France.

Kushner na di papa of Jared Kushner, wey be former White House senior adviser wey marry Trump oldest pikin, Ivanka.

Trump bin wipe im record for 2020 years afta e don serve im 2005 two years prison sentence for tax evasion, illegal campaign donations and witness tampering.

Wetin presidential pardon dey do?

E dey common for outgoing president to issue pardons bifor dem comot di White House .

Donald Trump give ova 100 pardons for im first term as president and most of dem happun for im last few months for office.

Presidential pardon dey wipe convictions for federal crimes.

E dey represent legal forgiveness, e dey end any added punishment and dey restore pipo rights like dia right to vote or to fit run for public office.

Which kain wahala Hunter Biden don face

Hunter Biden

Wia dis foto come from, Reuters

Hunter Biden bin dey only two years old for December 1972 wen truck run enta di family truck and kill im mama and younger sister Naomi.

Dis na less dan six weeks afta im papa bin win di election wey carry am enta US Senate.

Im papa no dey drink at all but you see Hunter, e start to drink as teenager and e bin don even admit say im bin abuse cocaine for im university days. E don dey in and out of rehab.

For 2013, e sign up for US Navy Reserve and dem swear am in in front of im papa, wey be vice president dat time, for White House ceremony.

But for im first day for naval base, dem test am positive for cocaine use and na so dem kick am out.

According to di New Yorker, e bin drink well-well afta im older brother Beau die of brain cancer for 2015. Sometimes e go just comot house go buy vodka.

For im kasala divorce from im first wife wey dem dey call Kathleen Buhle, she accuse am say e dey "spend plenti money for im interests (wey include drugs, alcohol, prostitutes, strip clubs, and gifts for women wey e dey sleep wit), but im family go dey witout money to pay for dia legit bills".