Wetin be assisted dying and why UK Parliament vote di bill?

Wia dis foto come from, PA Media
MPs for di United Kingdom don vote in favour of one bill to legalise assisted dying in England and Wales.
Di bill go face months of further kwesions and votes for di Commons and Lords bifor di proposed changes fit become law.
For now, laws throughout di UK no allow pipo to ask for medical help to die.
Wetin be di proposed law on assisted dying for England and Wales?
Na backbench Labour MP Kim Leadbeater bin introduce di Terminally Ill Adults (End of Life) Bill.
E propose to give terminally ill pipo di right to choose to end dia life.
E say anybody wey wan end dia life must:
- be over 18 and dey live in England and Wales, and don dey registered wit GP for at least 12 months
- get di mental capacity to make di choice and dey deem to don express clear, settled and informed wish, wey dey free from coercion or pressure
- dey expected to die within six months
- make two separate declarations, witnessed and signed, about dia wish to die
- satisfy two independent doctors say dem dey eligible - wit at least seven days between each assessment.
Under di proposals, one High Court judge go need rule each time one person make request to end dia life. Patient go den need to wait 14 days afta di ruling, to allow dem to have period of reflection.
One doctor go prepare di substance wey dem go use end di patient life, but di pesin go take am demselves. Di bill no tok which drug dem go use.
E go dey illegal to use dishonesty, pressure or coerce pesin to declare say dey wan end dia life, wit possible 14-year prison sentence.
How di MPs vote on assisted dying?
Di historic vote bin see 330 MPs wey vote in favour to allow assisted dying and 275 against am.
E bin follow five hours of passionate debate, wia MPs bin share personal tori dem and those against di bill bin call for better end-of-life care.
MPs bin get free vote on di issue, wey mean say dey fit make dia own decision rather dan follow party instructions. Di govment dey impartial on di issue.
Prime Minister Sir Keir Starmer dey among those wey vote in favour of di bill, as also Chancellor Rachel Reeves.
However, Deputy Prime Minister Angela Rayner, Foreign Secretary David Lammy, Health Secretary Wes Streeting and Justice Secretary Shabana Mahmood all bin vote against.
Among di Conservatives, Rishi Sunak and Oliver Dowden, di former prime minister and deputy prime minister, bin dey minority to support assisted dying. Kemi Badenoch, di new Conservative leader, bin vote against.
Wen MPs bin last vote on di issue for 2015, dey bin reject different proposals by 330 votes to 118.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wen assisted dying fit become law?
E still get many months of parliamentary activity ahead, but di bill now move forward wit di backing of di House of Commons.
E mean say dat kind law don move one step closer but e must still pass through five parliamentary stages handled by MPs and five more by peers, and further rounds of voting.
MPs bin hear say one period of up to two years go dey bifor any new law dey implemented sake of say "e dey more important to get dis right dan to do am quickly".
E also possible say di bill fit fall and no become law at all.
Who dey oppose assisted dying?
Opponents dey warn say pipo fit dey put under pressure to end dia lives and want improvements to palliative care instead.
Paralympian and House of Lords crossbencher Baroness Grey-Thompson na one vocal critic.
She bin tell di BBC say she dey worried about "di impact on vulnerable pipo, on disabled pipo, [di risk of] coercive control, and di ability of doctors to make one six-month diagnosis".
Who want di law on assisted dying to change?
Kim Leadbeater, di MP wey bin introduce di bill, bin tok say di law need to change sake of say some pipo "get one horrible, harrowing death", however good wey dia end-of-life or palliative care be.
She bin tok say her bill include "di strictest safeguards anywhia in di world".
One cancer patient Nathaniel Dye wey bin work wit Ms Leadbeater on her bill tok e go allow pipo death wey dey "as kind and compassionate as possible".
Di Dignity in Dying campaign group tok say di bill provide say "most detailed, robust proposals" on di issue wey "Westminster don ever consider".
According to chief executive Sarah Wootton, di fact say every year "up to 650 terminally ill pipo dey end dia own lives, often for one lonely and traumatic ways," shows say di status quo no dey work.

Wia dis foto come from, PA Media
One of di highest-profile advocates for change na broadcaster Dame Esther Rantzen, wey get stage-four lung cancer.
"All I dey ask for na say we dey given di dignity of choice," Dame Esther bin tell BBC News. "If I decide say my own life not worth to live, please I fit ask for help to die?"
Both di British Medical Association, wey represent doctors, and di Royal College of Nursing dey neutral on di issue.
Wetin be assisted dying, assisted suicide and euthanasia?
E get some debate over exactly wetin di various terms mean.
However, assisted dying generally dey tok about pesin wey dey terminally ill dey receive lethal drugs from one medical practitioner, wey dem administer demselves.
Assisted suicide na to intentionally help anoda pesin to end dia life, including pesin wey no dey terminally ill. Dat fit involve to provide lethal medication or help dem travel to anoda jurisdiction to die.
Euthanasia na di act to deliberately end one pesin life to relieve suffering wey lethal drug dey administered by physician. Patients fit no dey terminally ill.
E get two types: voluntary euthanasia, wia patient dey consent; and non-voluntary, wia dey no fit sake of say, for example, dem dey coma.
Wia euthanasia or assisted dying dey legal around di world?
Di Dignity in Dying campaign group say more dan 200 million pipo around di world get legal access to assisted dying.
Switzerland don dey allow assisted suicide since 1942. Dia Dignitas facility - wey dey accept foreign patients as well as Swiss nationals. Between 1998 and 2023 wia dem bin help 571 Britons to die.
Assisted suicide also dey legal in Austria.
For di US, 11 states - Oregon, California, New Mexico, Colorado, Washington, Hawaii, New Jersey, Vermont, Maine and Washington DC - dey allow "physician-assisted dying".
E dey permit doctors to prescribe lethal drugs for self-administration.
Voluntary euthanasia dey legal for Canada wia dem dey call am medical assistance in dying. E fit dey provided by doctor or nurse practitioner, either in person or through prescription of drugs for self-administration.
E also dey legal for Spain and Colombia, both of wey also permit assisted suicide.
Assisted dying also dey legal for some parts of Australia but di law dey different across states.
New Zealand End of Life Choice Act legalise assisted dying and allow adults wey dey dia final months of life to request assistance from medical professional.
Three kontries get laws wey allow pipo wey no dey terminally ill to receive assistance to die: Di Netherlands, Belgium and Luxembourg.






