Nigeria Immigration Service clarify wetin married, divorced women need to renew passport

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria Immigration Service (NIS) don come out to tok on one controversial mata wey tanda for social media ontop wetin married female applicants go need bifor dem go fit apply for di Nigerian passports or even to renew am.
No be today wey plenti married women dey complain say di Immigration Service dey request women to bring dia husband passport page if dem wan renew dia own passport.
Recently, one woman ask di NIS for social media ontop dis requirement wey she tok say e no suppose be like dat.
She lament how she go renew her own passport and she stop wen e reach di side wia dem ask for her husband passport page.
Dis mata dey come afta few months wey di Nigeria Immigration Service bin launch dia contactless passport application system wey no go require d applicants to visit any immigration office.
For November 2024, di Nigeria Immigration Service say dem don launch di ‘contactless passport application system’ wia capturing, finger print and everytin go dey online.
Immigration clarify di allegations
"I get birth certificate wey prove who I be. Information on my NIN prove my identity, yet becoss say my old passport carry my married name, I gatz attach my husband passport page or proof of im identity? What if I dey divorced? So I no longer be Nigerian?," X user IjeomaOgood ask di immigration for her page.
Meanwhile, afta plenti rofor-rofor, di immigration bin reply to clarify dis allegations for dia X page.
According to di NIS, dem say married women from Nigeria no need to attach dia husband passport page if dem want renew dia passport.
Di NIS add say no be official policy and to renew passport dey based on individual identity documents.
"Dey assured say no requirement dey for a married Nigerian woman to attach her husband passport page or proof of im identity in order to renew her passport. Dis be official policy," di immigration clarify.
Dem add say 'any claims wey dey suggest odawise na incorrect.'
But di NIS also tok say e get some requirements for change of data for pesin wey marry, pesin wey divorce and for parents wey wan collect international passport for dia pikin.
Di Nigeria Immigration Service say e get four scenarios wia passport renewal and collection fit happun.
But according to dem, na only two situations go require make married woman provide di International passport data page/NIN of her husband.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Requirements for change of data sake of Marriage
Di Nigeria Immigration Service say e get documents wey any Nigeria female wey wan collect new international passport for her husband surname sake of marriage need to get.
Di document include:
- Newspaper publication of change of name sake of marriage
- Wife Passport Data page
- Marriage certificate
- Husband passport data page/ or NIN slip
- NIN Slip
- Local govment certificate of origin
- Birth Certificate/ Declaration of Age
Requirements for change of data sake of Divorce
Also Nigeria Immigration Service say e get some documents wey any divorced Nigeria female wey wan collect international passport go need to make di process go well so she go fit go back to her maiden name.
Some of di document include:
- Decree Absolute
- International passport Datapage
- Newspaper publication to that effect
- NIN Slip
- Local government of origin certificate
- Birth Certificate/ Declaration of Age
Requirements for passport for children
NIS say for parents wey wan obtain international passports for dia children dem also need to have some documents.
Part of di documents required include:
- Consent letter countersigned by parent(s)
- International passport data page of parent(s)
- NIN Slip
- Local govment certificate of origin
- Birth Certificate/ Declaration of Age
Requirements for renewal for married women wey no dey change name,
DI NIS also clarify documents for passport renewal for married women wey no dey change her name.
Di required documents include:
- Expired international passport Data page
- NIN Slip
- Local government certificate of origin
- Birth Certificate/ Declaration of Age

Wia dis foto come from, Getty Images
How to apply for di contactless passport renewal process
NIS say Nigerians fit renew dia passport by themselves by downloading di NIS mobile app on dia phone, once di app don dey available for dia region or dem fit apply on dia website.
Once dem download di app or visit dia website, make applicants follow all di steps wey dey outlined, and e include:
Create profile: Applicant wey wan renew dia passport go need register wit valid email.
Eligibility check: Take one quick eligibility test to ensure say dia passport qualify for renewal.
Identify details: Provide dia National Identification Number (NIN) plus dia current passport number for verification.
Personal information and document upload: Enta dia bio-data and upload necessary documents like NIN, birth certificate, local goment certificate, among odas.
Biometric capture: Applicants go now fit use dia mobile device to capture dia fingerprint biometrics.
Make payment: complete di online payment to finalize di application process.
Submit application and wait for processing.
Di agency explain further say dem go process di application and deliver am to di address of di applicant.
How to apply for Nigeria passport for married and pikin
You fit apply for Nigeria passport ontop di immigration website and di following na requirements for person wey wan apply for fresh passport, for adult and minor:
- Letter of identification from Local Government/State of origin or residence or National Identity Card
- For goment employees: Letter of introduction stating Service Number, Length of Service and Designation/Rank.
- Valid staff ID card
- Completed passport application form
- Marriage certificate, where applicable.
- Birth Certificate (Pipo wey dem born from December 1992 must to submit certificate by di National Population Commission)
- Pesin wey no get birth certificate go provide age declaration document endorsed by a Commissioner for Oaths, wit one passport-sized photograph
- Acknowledgement Slip and Evidence of Payment.










