Trump plead not guilty to charges over 2020 election case

Wia dis foto come from, Reuters
Former US president Donald Trump don plead not guilty on Thursday to di federal conspiracy charges wey accuse am of suppressing di will of di pipo and overturning di 2020 United States of America election.
Bifor e take im plea, Trump answer basic kwesions from di judge and dem inform am of di charges wey dey against am and di potential penalties. Di most serious charges call for up to 20 years imprisonment
Trump appear bifor a magistrate judge for Washington federal courthouse two days afta dem indict am on four felony counts by special counsel Jack Smith.
Di charges mark di first effort to try to hold Trump criminally responsible for im efforts to block di transfer of power on 6 Jan, 2021.
Trump, wey be di 2024 Republican presidential primary front-runner, dey face charges on conspiracy to defraud di United States and obstruct Congress certification of Democrat Joe Biden victory.
Dis dey happun two months afta Trump plead not guilty to dozens of federal felony counts wey dey accuse am of hiding classified documents and thwarting government efforts to retrieve dem.
Trump tok say im dey innocent and im legal team don characterise latest case as attack on im right to free speech.

Wia dis foto come from, Reuters
Charges against Donald Trump
Trump wey don plead not guilty say e lie on purpose and repeatedly as im bin dey try to overturn im defeat for di 2020 presidential election - dey accused of four counts:
End of Di one wey oda users dey read well well
Conspiracy to defraud di US
Conspiracy to obstruct one official doings
Obstruction of one official doings
Conspiracy against di rights of citizens
Di first count na about alleged attempts to block di collection, counting and certification of votes.
Di second and third na about alleged attempts to block di certification of electoral college votes for di US Congress for 6 January, 2021 wey cause di Capitol riot.
Di fourth charge na about alleged attempts to interfere wit di citizens right to vote and make dia vote dey counted.

Wia dis foto come from, Getty Images
Trump, wey wear suit and red tie, sidon for di defense table.
Plenty attention dey as to how Trump has act inside di courtroom.
Di former president dey attentive throughout di hearing as e lean forward on top im chair and neva rest im hands on di table as e faces di judge directly.
"Dis case go benefit from normal order, including a speedy trial," one goment prosecutor tok bifor dem end di court hearing.
During di hearing, Trump lawyer John Lauro push back and e tok say im team need time to weigh "di scope and extent" of di justice department evidence in dis case, given dat di goment get three years to set forth dia side.
E add say a just and fair trial - wey go protect Trump constitutional rights - dey as important as a speedy trial
Judge Tanya Chutkan say hearing on di matter go hold on 28 August at 10:00 local time (15:00 BST).














