Wetin be di next tin for leader of South Africa second largest party wey comot from DA leadership?

South Africa's Democratic Alliance (DA) leader John Steenhuisen wit im mouth open and micorphone for im front

Wia dis foto come from, Rajesh JANTILAL / AFP via Getty Images

Read am in 4 mins

John Steenhuisen wey be di leader of Democratic Alliance (DA), South Africa second largest party don confam im exit comot from di leadership of di party.

Di Democratic Alliance (DA) na big party for South Africa and dem bin enta into coalition wit dia political rival African National Congress (ANC) for 2024 afta dem lose di parliamentary majority.

Local media for South Africa say Steenhuisen don lead im party, di Democratic Alliance (DA), to achieve different electoral success for South Africa during di period wey e dey lead di party.

Steenhuisen bin take ova di leadership of di Democratic Alliance (DA) for 2019 as Federal Leader and e currently dey serve as agriculture minister for President Cyril Ramaphosa govment.

Di exit of John Steenhuisen dey come just few months to di election of di party wia dem go change leadership.

Some reports say di 49-year-old bin dey expected to run again for di leadership of di party, but e gatz abandon im bid.

According to di statement by di national tok tok pesin of Democratic Alliance, Jan de Villiers, e say di party dey happy for di six years of Steenhuisen leadership.

"Under im leadership, di DA no only strengthen dia institutional stability and electoral performance, but achieve historic breakthrough by entering national govment."

Wat next for John Steenhuisen?

John Steenhuisen na agriculture minister for South Africa, and im exit comot from di DA leadership race go allow am focus on im work.

E say im no go seek re-election as DA party leader for April, and some dey see am as sometin wey fit threaten di stability of di coalition govment.

"For di rest of dis term of office, I go focus all of my time and energy as minister of agriculture on defeating di most devastating foot-and-mouth disease outbreak our country don eva see," Steenhuisen tok for press conference.

As Minister of Agriculture, Steenhuisen don face different pressures from farmers wey dey demand say make e find ways wey di diseases wey dey threaten dem go stop.

Foot and mouth disease na disease wey dey comot from farm animals, and South Africans say di disease dey threaten dia food security.

During di press conference, Steenhuisen say im next work na to find how to 'eradicate dis disease from our shores'.

"As John now focus fully on im responsibilities as Minister of Agriculture for di Govment of National Unity; particularly to respond to di current foot-and-mouth disease outbreak," DA tok for dia statement on wetin Steenhuisen go focus on next.

DA dey hope say South Africa farmers, rural communities, and food security go fit benefit from di full-time attention wey Steenhuisen dey bring as e exit di party leadership.

John Steenhuisen take ova as Federal Leader of Democratic Alliance (DA) for 2019 wia e oversee di party electoral growth for di 2021 and 2024 elections.

DA later become a leading opposition for South African politics.

Steenhuisen begin im political journey for age 22 wen dem elect am to di council of di port city of Durban for di Democratic Party.

E rise up through di party local and regional leadership bifor e become leader of di party, wey later traditionally get white support base, two decades later.

Steenhuisen suppose run unopposed for di leadership for DA upcoming conference for April, but e drop.

Under Steenhuisen, di DA party agree to join di ANC as dia biggest partner for di govment of national unity nearly two years ago.