Lagos lawmakers re-elect Obasa as Speaker as Meranda resign

Wetin we call dis Video, Obasa take oath of office
Read am in 3 mins

Di lawmakers for Lagos State House of Assembly don re-elect Mudashiru Obasa wey dey represent Agege Constituency I as Speaker afta Mojisola Meranda resign on Monday 3 March.

Meranda wey dey represent Apapa Constituency I bin announce her resignation on Monday and lawmakers re-elect her as di Deputy Speaker of di Lagos State House of Assembly.

Obasa re-election follow di nomination by one former Majority Leader of di House, Noheem Adams, wey dey represents Eti-Osa Constituency 1.

Di Agege lawmaker bin take oath of office as di new Speaker of di Lagos State House of Assembly seven weeks afta im removal from office on 13 January.

Dem bin remove Obasa sake of allegations of gross misconduct, poor leadership, mismanagement of funds and corruption.

Afta Obasa removal, di majority of di lawmakers bin elect and swear-in Madam Meranda as di new Speaker.

Dem first elect Obasa into di House for 2007 and e become Speaker for June 2015 bifor im removal for January 2025.

Meanwhile, di lawmakers bin commend Madam Meranda leadership style and for bringing peace to di Lagos State House of Assembly.

Meranda and Obasa

Wia dis foto come from, Mojisola Meranda/X, Mudashiru Obasa/Instagram

Dem also commend her strength and humility for obeying di rules and regulations of di All Progressives Congress.

Meranda resignation happun afta meeting wit some high-ranking members of di APC for di state to solve di Assembly crisis.

Last week, di impeached Speaker bin maintain say im removal no hold water and e dey illegal as lawmakers no follow constitution to remove am, and e declare say im remain di legitimate speaker of di house.

"I don resume and I still remain di Speaker of di Assembly," Oga Obasa tell tori pipo for di Assembly complex on Thursday 27 February.

"Nobody remove me. Impeachment or removal na democratic and constitutional, but if you wan do am, you gatz follow due process. We get rules for dis House and House rules wey all state Assemblies for di south-west dey follow, but dem no follow am," e tok.

Also, for one interview wit Channels TV on Thursday 27 February, Obasa claim say Madam Meranda don agree to resign as di Speaker during one peace meeting wey leaders of di party for di state arrange.

"One meeting hold for Marina wia we get in attendance all di party leaders and all di members [of Lagos Assembly] and openly Meranda hersef tok say she don step down and she don resign."

One video on Monday 3 March show how lawmakers hail and clap for Madam Meranda as she return to her former seat for di Assembly.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post