Wetin Governor Fubara tok inside broadcast wey reply Supreme Court judgement on Rivers state political crisis

Governor Siminalayi Fuabara

Wia dis foto come from, Rivers State Government

Wetin we call dis foto, Rivers state Governor Siminialayi Fubara for di state broadcast
Read am in 4 mins

Rivers State Governor Siminialayi Fubara don direct di local government chairmen for di 23 local governments areas to hand over to di heads of local government administration for di various council secretariats.

Fubara give di directive for state broadcast, im first public reaction, in obedience to di order of di Supreme Court judgement wey cancel di local goment election wey bring in di local goment chairmen dem.

Dis na di first official response of di governor to di recent Supreme Court judgements and pronouncements regarding aspects of di political crises for di state.

Wetin Fubara tok for di broadcast?

Governor Fuavara say although dem disagree with di judgements, dem dey bound to obey di orders wey e make as a law-abiding goment becos since dem come into power, e say dem don conduct di affairs of goment within di framework of di constitution, due process and di rule of law.

"While we no dey above mistakes as humans, we believe say we never, as a goment, do anytin deliberately to trample on di rule of law or di hallowed principles of constitutional governance.

Accordingly, I don hold meeting with my team of lawyers and dem don assure me say di certified true copy of di judgements fit dey available to dem by Friday, 7th March, 2025."

Di governor say as soon as dem get di certified judgements, dem go study di ramifications and implement dem without reservations to move di state forward.

In di meantime, di governor direct heads of local government administration to immediately take over di administration of di 23 local goment councils pending di conduct of fresh elections by di Rivers State Independent Electoral Commission, RSIEC.

Wetin Fubara no address for im broadcast

Di Rivers Governor no tok on di oda orders wey di Supreme Court give becos on Friday 28 February 2025, di Supreme court of Nigeria order di Accountant-General of di federation to also cease all fund to Rivers state government until di governor present budget to di legitimate hHouse of Assembly.

Di five-man panel also declare Martins Amaewhule as di legitimate Speaker of di state assembly.

Governor Fubara say wen dem get di certified true copy of di judgment and look am well dem go know di next steps to take.

One of di matters bifor di Supreme Court na di one concerning di judgement of di Court of Appeal for July 2024 wey nullify di removal of Martin Amaewhule and 24 odas as members of Rivers State House of Assembly.

Oga Amaewhule na di Speaker of di faction of di River State Assembly wey no dey gree wit Governor Fubara sotey dem bin announce say dem don comot from di Peoples Democratic Party (PDP) to join di All Progressives Congress (APC), di lawmakers later make U-turn say dem no be registered members of di APC.

But afta dat announcement, Fubara bin carry di matter go court to ask di court to sack di lawmakers wey defect, sake of wetin constitution tok say lawmaker wey leave im party go also vacate di seat.

Justice Charles Wali of di Rivers State high court bin grant di order on 10 May 2024. E stop Martin Amaewhule from parading imsef as di Speaker of di Rivers State House of Assembly, and also bar di 24 oda members from entering di assembly complex or carrying out any legislative assignment in di name of di Rivers State House of Assembly.

However, di court of appeal, on 4 July, 2024, overturn di judgement and return Amaewhule and di oda 24 members.

Meanwhile anoda case dey bifor di Federal High Court for Port Harcourt wey Victor Oko-Jumbo and two odas bring against Martin Amaewhule and 24 oda Rivers Lawmakers on dia defection from di PDP to di APC still dey pending.