Why King Charles dey Canada and wetin be di throne speech?

Wetin we call dis Video, Watch: Why King Charles III trip to Canada dey more dan just a royal visit
    • Author, Ali Abbas Ahmadi
    • Role, BBC News, Toronto
  • Read am in 5 mins

Di pomp and pageantry go dey on full display wen King Charles land for Canada for di first time since im coronation.

E go deliver di Speech from di Throne to open di 45th session of Canada parliament in Ottawa on Tuesday.

Di King na di head of state of Canada - and of 13 oda Commonwealth realms like Australia, New Zealand and some Caribbean states - as well as di UK.

Di King, wey go travel wit Queen Camilla, bin first journey to Canada several times as di Prince of Wales. Dis na im 20th visit.

Wetin be di Speech from di Throne?

Dis address traditionally dey given by di govnor general, wey be di monarch top representative in Canada.

Dem am read am on behalf of di prime minister, to set out di govment agenda wen a new parliamentary session dey about to begin.

Canada House of Commons and Senate no fit conduct any public business bifor di Speech from di Throne dey made.

Na so-called sake of say e dey typically read from di seat in di Senate chamber wey dey reserved for di monarch or dia representative in Canada.

Di current govnor general na Mary Simon. But dis time, newly elected Prime Minister Mark Carney don invite di King imself to inaugurate di new parliament. E dey scheduled to do so on Tuesday.

Wen be di last time wey Canada head of state read di throne speech?

Elizabeth II gives a speech to Canada's parliament

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Elizabeth II deliver di address in 1977

While e no dey unprecedented for di throne speech to dey read by di monarch, di last time dis bin happun na October 1977, wen Elizabeth II bin read di speech for di second time. Di first na for 1957.

Dis go be di first time wey a king go open a new session of parliament. King Charles grandfather George VI bin grant royal assent to several bills wen e bin visit Canada in 1939, but e never deliver a throne speech.

Why di King dey invited to Canada?

Earlier in May, Prime Minister Mark Carney bin tok say e invite di King to formally open Canada 45th session of parliament.

Im request dey viewed as a strategic one, as e come amid strained ties between Canada and im powerful neighbour di United States.

US President Donald Trump don impose tariffs on Canada, and don repeatedly refer to am as di "51st state". E also disparagingly refer to Carney predecessor Justin Trudeau as "Governor Trudeau".

Wen e bin tok for Ottawa, Carney tok say di King visit "clearly underscore di sovereignty of our kontri". E bin tell reporters: "Dis na historic honour wey match di weight of our times."

Canada Governor General Mary Simon bin tok say di visit "highlight di enduring relationship between Canada and di Crown".

"Now more dan ever, we need to come togeda to make sure a future wey build on our shared global values of democracy, equality and peace," she tok.

Wetin we call dis Video, Watch: Wetin di Canadians make of di monarchy in di Trump era?

Wetin we know about di visit?

King Charles and Queen Camilla go land Ottawa Macdonald-Cartier International Airport for 13:15 EST (17:15 GMT) on Monday, wia dey go dey greeted by Govnor General Mary Simon, Prime Minister Mark Carney and im wife, Diana Fox Carney.

Assembly of First Nations National Chief Cindy Woodhouse Nepinak, Inuit Tapiriit Kanatami President Natan Obed, and Métis National Council President Victoria Pruden also dey expected to dey di airport.

Di trip go begin for Lansdowne Park, wia di royal couple go meet individuals and organisations showcase Canadian identity and diversity.

Dey go den make dia way to Rideau Hall - di residence of Canada govnor general and di official residence of di monarch when in Canada. There, the King will take part in a tree-planting ceremony.

E go den have separate meetings wit Simon and Carney.

On Tuesday morning, di King and Queen go head to Canada Senate accompanied by a royal escort, where dey go receive full military honours - including a 100-person guard of honour from di 3rd Battalion of di Royal Canadian Regiment, an inspection of di guard and di band, and a 21-gun salute.

At 11:00, di King go deliver im Speech from di Throne to open di 45th session of parliament.

Di royal couple go den pay dia respects to Canada fallen soldiers for di National War Memorial, bifor e leave di kontri later dat day.

How di King don show support for Canada?

King Charles meets a servicewoman on the HMS Prince of Wales

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, King Charles bin wear Canadian medals wen e bin visit di HMS Prince of Wales aircraft carrier in March

For im role as head of state, di monarch dey expected to avoid straying into politics. E instead appear to don send coded signals and make symbolic gestures of support for Canada amid Trump threats.

Di King bin praise Canada as a "proud, resilient and compassionate kontri" in February, on di 60th anniversary of di first raising of di kontri maple leaf flag - one event wey fit don otherwise pass without royal intervention.

Wen e bin visit aircraft carrier HMS Prince of Wales on 4 March, e appear to wear one set of Canadian medals.

Di same month, wen e bin sit for di Commonwealth Service - one annual celebration of Commonwealth kontries in London - e bin do so on a Canadian chair.

And at a tree-planting ceremony at Buckingham Palace earlier dis year, di tree wey e choose na maple.