'My parents and three siblings burn to death bifor my eyes for military attack'

People laid on the mats, about to be buried
Read am in 5 mins

Tears flow from her eyes as nobodi fit console am sake of say she experience di moment her parents and three younger siblings burn to death for Sokoto State.

Di tragedy wey strike Hauwa'u also strike oda pipo wey lost family members to di airstrikes by di Nigerian military on Wednesday 25 December.

Tori be say di airstrikes kill 10 pipo and and injure six odas for Rumtuwa and Gidan Sama for Silame local goment area for Sokoto State, northwest Nigeria.

'I see fire dey burn dem'

Despite attempts by pipo around to calm her down, di only tin Hauwa'u fit tell BBC na, "I see dem burning, my mama, my papa, and my three younger siblings."

One resident of di local goment Malam Muhammad wey follow BBC News Pidgin tok say na 7am di incident happun as soldiers enta di two villages.

Nigerian Air Force jet

Wia dis foto come from, Facebook/ Nigerian Airforce

Muhammad wey dey live near di villages wia di incident happun say, "For di morning between 6am to 7am somtin, soldiers surround di communities for ground, later three aircraft begin dey drop bomb."

Di villager tok say afta di bomb don finish, pipo for Lemi, Gwandawa, and oda nearby villages come out to see wetin happun.

But di man say wen dem try reach di villages, di soldiers no gree make dem enta.

"Na later wen tins begin dey calm down we approach di communities to see for our eyes wetin happun but military no let us go close," im tok.

According to wetin Muhammad tok, di chairman and di chief for Silame go di villages to see wetin happun wit dia own eyes.

Anoda villager Usman Manuga wey follow BBC tok say di incident happun afta di Asr prayers.

"After we pray, we come out. I bin go greet my parents. I hear pipo dey say, 'Look, look, look,' and I come out and see dem wit my own eyes."

"I bin dey dia wen one of dem hit us."

In addition to di 10 pipo wey die and dose wey injure, estimate of 100 animals also die for di attack.

Di animals include camels, cows, sheep, and donkeys.

'Di airstrike na by mistake' - Ahmad Aliyu

A man speaking to the mic

Wia dis foto come from, Ahmad Aliyu/Facebook

Sokoto State Govnor Ahmad Aliyu wey bin attend di burial of dose wey die for di attack say di "military carry out di attack by mistake".

"Dis situation na fate, dis officials act in error, and dem do am to protect dis community."

"You get news say e get some pipo wey don come into dis kontri, and dis no be di first time dem (di soldiers) don attack dem, dem don attack di first time, dem don attack di second time and dem don attack di third time, and dem all dey successful, so dis dey considered as destiny, and as Muslims e good make we accept destiny, good or bad," di govnor tok.

"We go work wit all relevant authorities to ensure say investigation dey carried out to determine di cause of di incident and to consider di course of action to prevent a recurrence."

Di govnor say e don deliver about 100 bags of food aid and about 20 million naira to di affected community.

'Na air force and ground force carry out di attack'

Silame local goment chairman Abubakar Muhammad tell BBC say na both air force and ground force carry out di attack.

"Di air force enter di area wit heavy tanks."

"Dem call me dis morning (Wednesday) and tell me say bombs don drop, and I investigate and confam say dis happun."

Di local goment chairman, wey say im and di state Govnor Ahmad Aliyu bin dey among dose wey bury di victims of di attack, say "two warplanes drop bombs" on di villages.

"Na places wey dem dey call Gidan Bisa and Runtuwa wey be my constituency."

"Dis na relentless attacks," wey Abubakar explain say di military no stop until di state goment intervene.

Di villages dey located near di Surame desert, wey dey considered as hideout for di Lakurawa militant group wey recently emerge for di kontri.

Nigerian military react

Di tok-tok pesin for di Operation Fansan Yamma, Lieutenant Colonel Abubakar Abdullahi, no confam if di military jets strike di communities.

E tok say Lakurawa and oda terrorist groups "fit attempt to undermine military successes through media disinformation, wey necessitate caution concerning unverified claims, especially for di ongoing fight against terrorism and banditry".

E say di Joint Task Force North West Operation Fansan Yamma don address recent reports wey concern a military "fighter jet wey allegedly bomb civilian structures for di Silame Local Goment Area of Sokoto State".

"Dis reports don raise concerns; however, e dey crucial to clarify say all military operations dey conducted based on thorough intelligence and reconnaissance missions. Dis rigorous process dey particularly important wen targeting groups like di Lakurawa terrorist organisation, as e aim to ensure precision and protect civilian lives.

"Sake of di serious nature of dis operations, di public dey urged to rely on confam information to prevent misinformation and unnecessary panic.

"Importantly, di targets wey dey struck for di vicinity of Gidan Sama and Rumtuwa don dey positively identified as associated wit di Lakurawa group, dis reinforce di justification for di military action taken," Abdullahi tok.

Di latest airstrike dey come barely one year afta di Nigeria military bin kill 85 civilians and wound 66 during one religious celebrations for Tudun Biri village for Kaduna State for northwest Nigeria.

Na around 10pm on 3 December, 2023, di Nigerian military bin launch one airstrike for Tudun Biri village - one village wey near Kaduna.

Dem launch anoda airstrike around 30 minutes afta di first one, e kill dozens of pipo including di pipo wey rush go di place to rescue victims wey di first strike bin hit.

Di army blame power intelligence for di mistake.