Wetin next for South Korea after President Yoon Suk-yeol dey removed from office

Yoon Suk-yeol

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, President Yoon Suk-yeol
Read am in 4 mins

South Korea political ground don shake well well afta di Constitutional Court comot President Yoon Suk-yeol for office, dis don clear road for a snap - quick - presidential election.

Di panel of judges for di Constitutional Court togeda vote to uphold Yoon Suk Yeol impeachment.

E mean say e dey immediately removed from im position as president. Di country go now get 60 days to hold one snap election to replace am.

For court, afta di judge hear from both sides for pipo wey support di impeachment and those wey no support am, di main argument be whether Yoon declaration of martial law na against di constitution.

Di judge tok say President Yoon no follow due process wen e bring in martial law.

Di court find say di way Yoon use im "national emergency powers" no make sense or no get strong reason.

Justice Moon Hyung-bae, wey dey act as president of di constitutional court, tok say, "No be real national emergency dey ground."

He still tok say, "Na situation wey dem for solve in oda ways wit out using soldiers."

Di judge also tok say Yoon carry soldiers come out to do martial law wahala, and e spoil di power and respect of di National Assembly wey be South Korea parliament.

"E no do im work well and e go against di people wey im suppose protect," Justice Moon talk.

Who dey likely to run for di snap presidential election?

Lee Jae-myung, wey be oga for opposition Democratic Party, na im dey lead for all di people wey wan run for president now.

For inside di ruling People Power Party (PPP), dem dey expect serious primary election wahala, as big big names like Minister of Employment and Labor Kim Moon-soo, Seoul Mayor Oh Se-hoon, Daegu Mayor Hong Joon-pyo, and former PPP oga Han Dong-hoon go show face.

Among all of dem, na Kim pipo dey support pass for now. But Lee Jae-myung still dey ahead as im approval rating na almost three times pass Kim own.

Han Dong-hoon, wey before be close padi to former President Yoon, don tok say e go do everytin to stop wetin he call Lee "one-man dominance."

E no clear who else for PPP go join di race, but many political analysts dey tok say time don almost finish for any conservative candidate to fit catch up with Lee Jae-myung before di election wey remain less dan two months before e happun.

Outside PPP, one 40-year-old lawmaker from Reform Party, Lee Jun-seok, don also dey draw attention. For one BBC Korean interview for December, Lee tok say e go run, and promise say e go bring "complete generational shift."

Background of wetin happun for South Korea

South Korea president shock di country on Tuesday 3rd December, 2024, out of di blue, e declare martial law for di Asian democracy for di first time in nearly 50 years.

Yoon Suk Yeol drastic decision - wey e announce inside a late-night TV broadcast - mention "anti-state forces" and di threat from North Korea.

But e soon become clear say no be external threats cause am but na im own desperate political palava.

E make thousands of people to gather for parliament to protest, while opposition lawmakers rush dia to do one emergency vote to remove di measure.

Yoon go later show few hours later, to accept parliament vote and lift di martial law order.

Dat time, Kim Yong-hyun wey be member of di Democratic party central committee, tok say "we no fit allow democracy collapse. Di lives and safety of di pipo need to dey protected".

Protests happun all ova di city ova di mata.

South Korea biggest labour group wey dem dey call di Korea Confederation of Trade Unions bin promise say dem go go indefinite strike till di president step down.

For Wednesday 4th December, 2024 South Korea opposition lawmakers start impeachment process against President Yoon Suk Yeol.

For January, South Korea Yoon Suk Yeol become di kontri first sitting president to chop arrest.

Im arrest end a week-long standoff between investigators and im personal security.

Yoon failed attempt to impose martial law bin throw di kontri into kasala and parliament impeach am.