Akwa Okuko, Eke Hit and Onye eze jesus show for court to answer allegations ontop Oke-ite

Di native doctors as dem land court
Read am in 4 mins

One state High Court Awka, Anambra State don fix 11 April, 2025 as date to arraign three native doctors wey government arrest.

Justice Jude Obiorah say di adjournment na to allow proper service on di defendants.

Di native doctors na Onyebuchi Okocha alias Onyeze Jesus, Chidozie Nwangwu wey pipo sabi as Akwa Okuko, and Ekene Igboekweze alias Eke Hit.

Di Anambra goment accuse di three native doctors of criminal activities, including preparing Oke-ite, dat na charm to use get money.

Remigus Okoli, one of the Counsels for di three defendants, tell tori pipo say di state goment come wit plan to remand di defendants.

E say proper service and giving accused enof time to prepare for defense na sometin wey di court wan take serious.

Oga Okoli say di allegation against di defendants no matter becos dem get right to fair hearing.

Di goment lawyer F C Okeke no gree to about di mata.

Chidozie Nwangwu wey pipo sabi as Akwa Okuko and Ekene Igboekweze wey pipo sabi as Eke Hit, chop arrest in February ontop allegation say dem allegedly get hand for illegal activities for di state.

Dia arrest bin dey based on a new law wey di state Govnor Chukwuma Soludo sign for January to tackle increasing insecurity.

Dis new law wey di name na 'Anambra State Homeland Security Law 2025' also get provisions to stop wetin di goment describe as di increase of fake traditional priests and priestesses wey dem say na im dey behind rising insecurity for di region.

Di arrest of one of di native doctors suspect wey dey popularly known as Eke Hit

Wia dis foto come from, Anambra Broadcasting Service

Di law na primarily to establish a security outfit for di state called Agunechemba. However, section 18 of di law tok about decriminalisation of money rituals.

Di section say: "Any pesin wey administer powers or charm on any oda pesin for di purpose of commission of any offence or for di purpose of accumulation of wealth by supernatural means oda dan by any known lawful means of livelihood commit offence and e dey liable on conviction to imprisonment for a term of six years wit option of fine of 20 million naira or both".

Di law also tok say na offence for anybodi to claim say e get supernatural powers, and anybodi wey dey arrested for di offence get to prove say e get di powers true-true or im go dey liable to conviction of six years imprisonment or fine of 20 million naira or both.

Wetin you suppose know bout Akwa Ọkụkọ

Chukwudozie Nwangwu alias Akwa Okuko

Wia dis foto come from, Akwa Okuko/Facebook

Wetin we call dis foto, Chukwudozie Nwangwu alias Akwa Okuko

Dem born Akwa Okuko wey im real name na Chukwudozie Nwangwu for 1998.

E come from Oba village for Idemili North local goment for Anambra state, south east Nigeria.

Na very popular native doctor na why dem dey call am "Akwa Okuko".

Tori be say na also be businessman wey get one hotel wey dem dey call Triple P for Oba.

Na for social media e dey take share tori about im native doctor work.

E recently receive yabis afta im bin invite Anglican priest to come open im hotel and give money to one gospel artist, Gozie Okeke.

Im sef dey show im prayers and religious songs for social media togeda wit displaying wealth.

Who be Eke Hit?

Ekene Igboekweze alias Eke Hit

Wia dis foto come from, Ekene Igboekweze/Facebook

Wetin we call dis foto, Ekene Igboekweze alias Eke Hit

Im real names na Ekene Igboekweze, and e hail from Umuofo Okija, a rural community for Ihiala local goment area of Anambra State.

For one Interview, e tok say di name 'Eke Hit' come from one customer who im bin work for and afta di work dey successful, di man nickname am 'Eke Hit' - Eke from im first name and 'Hit' to show say e dey always hit im target wit im medicine.

Eke Hit tok say e inherit di practice of native doctor from im father Nwokocha Igboekweze. According to am, im mama born 12 children but na only im dey alive.

E bin dey go Catholic church and bin dey for Mass Servers, bifor e later enta Watchman. E bin do travel to Ghana to do business but later come back as e claim say na di spirit of im father carry am come back.

Di man dey always boast say "if I do medicine for you and e no work afta four days I go refund your money".

Even though im na native doctor, Eke Hit tok say e also believe in God and im dey go church once evri year.