White House fire National Security Agency chief

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Madeline Halpert
- Role, BBC News, New York
- Read am in 6 mins
Trump administration don sack di oga of both di National Security Agency and US Cyber Command, BBC US partner CBS report.
Di removal of General Timothy Haugh dey come for di middle of wetin be like wider purge of top security officials for di agency and for di White House.
Democrats tok say dem dey "deeply disturbed" by di move and say e fit put national security at risk.
E no dey clear why dem remove Gen Haugh, but e dey come afta one meeting between President Donald Trump and far-right activist Laura Loomer on Wednesday.
Reports tok say Ms Loomer bin tell Trump to fire specific employees wey she suspect say no support im agenda.
She post on X say Gen Haugh and im deputy Wendy Noble, wey US media report say also chop sack, "bin dey disloyal to President Trump. Dat na why e fire dem."
Bifor tori pipo report dia sack, Trump bin tell reporters say im go sack any staff wey im administration reason say e no dey loyal.
"Many pipo go go – pipo wey we no like or pipo wey dey take advantage, or pipo wey dia loyalties fit dey to anoda pesin," e tell tori pipo aboard Air Force One.
Di top Democrats for di House and Senate intelligence committees - Representative Jim Himes of Connecticut, ranking member of di House Intelligence Committee, and Senator Mark Warner of Virginia, vice chair of di Senate Select Committee on Intelligence - disclose Gen Haugh firing give CBS.
Himes for statement say im dey "deeply disturbed" by di decision, CBS report.
"I know General Haugh say e be honest and forthright leader wey follow di law and put national security first — I fear those na di exact qualities wey fit lead to im sack for dis Administration," Himes tok.
Those wey dem fire from di NSC on Thursday include Brian Walsh, one director for intelligence; Thomas Boodry, one senior director for legislative affairs; and David Feith, one senior director wey dey oversee technology and national security, CBS report.
E neva dey clear if Gen Haugh and Ms Noble removals dey connected to di one wey happun for NSC.
Di firings dey come afta one major controversy wey involve NSC last month wen senior officials mistakenly add one journalist to one Signal messaging thread about military strikes for Yemen.
Gen Haugh, wey no dey on di Signal chat, testify for Capitol Hill last week about di leak.
Trump administration fire three National Security officials afta meeting wit Laura Loomer
Trump administration don sack at least three officials for di National Security Council, and more firings dey expected, according to BBC US partner, CBS News.
E neva clear why dem comot di staffers from dia roles, but CBS report say di decision come afta one meeting between far-right activist Laura Loomer and President Donald Trump for di White House on Wednesday, 2 April.
Loomer bin encourage Trump to fire specific NSC employees wey she reason say no dey loyal enough of di president agenda, according to several US media reports.
Di White House tell BBC say di National Security Council "no go comment on personnel" matters.
Di sacking also dey come as di NSC dey recover from one major kasala wey happun last month, wen senior officials mistakenly add one journalist to one Signal messaging thread about di military strikes for Yemen.
E no dey clear weda di controversy get hand for di firing.
Trump bin support di officials wey involve for di incident, including National Security Adviser Mike Waltz, wey reports tok say add di journalist to di Signal chat by mistake.
Those wey dem fire from di NSC on Thursday, 3 April include Brian Walsh, one director for intelligence; Thomas Boodry, one senior director for legislative affairs; and David Feith, one senior director wey dey see oversee technology and national security, according to CBS News.
For one statement to US media, Loomer tok say she no go give out any more details on top her meeting wit Trump "out of respect for President Trump and di privacy of di Oval Office".
"Na honor e be to meet wit President Trump and present am wit my findings, I go continue to work hard to support im agenda, and I go continue repeat di importance of strong vetting, for di sake of protecting di President and our national security," she tok.
Who be Laura Loomer?
Ms Loomer dey popular for her anti-Muslim rhetoric and for spreading conspiracy theories, wey include say di 9/11 attacks na one "inside job" wey di US government carry out.
She bin join one Trump for one event wey dey commemorate di attacks for 2024, wen e still dey campaign for di election, and e raise eyebrows and pipo para for some US media outlets.
some senior Republican politicians don publicly criticised Ms Loomer and dem caution against Trump bringing her into im inner circle.
"Laura Loomer na crazy conspiracy theorist wey often dey tok disgusting garbage wey di intention na to divide Republicans," North Carolina Senator Thom Tillis bin write on X.
Dem born her for Arizona for 1993. Di self-styled investigative journalist don work as activist and commentator for organisations wey include Project Veritas and Alex Jones's Infowars.
For 2020, she bin run - wit Trump support - as Republican candidate for di US House of Representatives for Florida, but she lost to Democrat Lois Frankel.
She try again two years later, wen she she try to unseat Representative Daniel Webster for one Republican primary for different Florida district, but she still lose.
Now, she dey known for her vocal support for Trump and for promoting plenty conspiracy theories wey bin include claims say Kamala Harris no be black, and say di son of billionaire George Soros bin send coded messages wey call for Trump assassination.
These posts bin lead to her ban on many platforms wey include Facebook, Instagram and even, according to her, Uber and Lyft sake of say she make offensive comments about Muslim drivers. She once describe herself as a "proud Islamophobe".
Ms Loomer dey often attend events wey dey in support of Trump and pipo bin see her for im Florida residence Mar-a-Lago.
Early 2024, she bin travel on Trump plane go Iowa, and e hail her on stage for one event. "You go need her on your side," Trump bin tok.
And last year, New York Times bin report say Trump bin wan employ her on im campaign, e only relax afta top aides express concern say she fit damage im electoral efforts.









