Morocco beat Senegal to secure Wafcon 2024 quarter-finals ticket

Wia dis foto come from, CAFwomen/X
Morocco beat Senegal wit one goal to top group A of di ongoing Wafcon and to earn dia quarter-final ticket.
Wit dis scoreline, host kontri Morocco don qualify go di next stage of di tournament wit seven points.
Senegal go still dey wait for any magic wey go happun for dem wit dia three points.
Lionesses of Teranga bin try dia best against Morocco but e no produce goals for dem afta di Atlas bin score from a penalty.
For di 35th minutes Morocco player Ghizlane Chebbak bin push forward wit di ball to create a chance, she dribble di defender and di goalkeeper rush out ooooo, but she fire di shot wide.
Senegal goalkeeper Adji Ndiaye bin really save her team since as she no gree make any goal enta di back of di net.
Until two minutes added time wen Morocco see chance through a penalty.
Di referee bin award penalty give Morocco afta Senegal goalkeeper give Morroco player a jab for mouth inside di box 18.
Dis na dia chance wey Morocco take shine and put diasef ahead of di Lionesses of Teranga.
Yasmin Mrabet step forward to score a beautiful penalty kick wey put Morocco for di early lead.
Afta di half-time, no magic bin happun as both teams bin battle am out for di second-half.
Fatima Tagnaout do some incredible dribbles for di side of Senegal box 18 for di 63rd minutes, but sadly she fire shot into di hand of Senegal goalkeeper Ndiaye.
Wen game enta 90 minutes, two players go down from a tackle against diasef, Senegal player Mama Diop collide wit Morocco goalkeeper Khadija. And by di time wey game go kontinue, time to equalise for Senegal no dey again.
Morocco and Zambia don get confidence of dia move to play for di quarter-final of Wafcon, wit seven points each from di group stage.
SECOND HALF
Morocco 1 - 0 Senegal
FULL-TIME
Senegal no see chance take equalise, na so referee blow whistle ooooo
90+6mins - What good placement of ball by Chebbak. She go happi if di referee count dis as goal but e no count
Be like say Morocco go sail through to di quarter-final oooo. As Senegal no see chance score a goal
90+4mins - Di match dey on hold as Morocco goalkeeper dey ground again afta she save anoda ball. Referee dey decide weda to add ore time or not.
90+2mins- Fast run by di Morocco player, but di Senegal defender pull di ball back wit a block. Chebbak hit di ball straight into Senegal box 18 but dem block am.
5 MINUTES ADDED TIME
Referee dey attend to dem.
90mins- Two players down from a tackle against diasef, Senegal player Mama Diop collide wit Morocco goalkeeper Khadija.
89mins- Good chance for Senegal, but Morocco block di ball
87mins- YELLOW CARD' Morroco star player Ghizlane Chebbak don later chop yellow card oooo.
85mins - Di Morocco midfield don dey free, as dia midfielder don dey join hand defend dia goal.
82mins- Hapsatou Diallo out for Senegal, Ndeye Casset don enta. Which magic she go fit perform for di team. Any equaliser go show from here?
81mins- Diallo dey play from di left for Senegal and her role na to distribute dat pass wey fit give di team some goal, but noting don really come out from her angle, as di defenders dey give her tight marking.
Morocco 1 - 0 Senegal
YELLOW CARD' Korka Fall chop yellow card for dat rough play wey she do.
79mins- Fatima Tagnaout wit her jersey number 11 strike from di left side, approaching di Senegal box 18. So much power and energy wit di ball. But Ndiaye catch di ball for Senegal
75mins - Yasmin Mrabet don fall oooooo, she jump to nod ball but she fall afta Senegal player chance her. Referee don blow for foul shaaa.
74mins- Be like say dis two coaches dey worry as dem dey eye di quarter-final and dis game mean so much, Two of dem stand for side of di pitch as dem dey give instructions to dia players.
73mins- FREE KICK for Senegal. Nguenar wit good tactic to win di ball, di free kick to enta net. Ball go back to play
71mins- SUBSTITUTION' Lahmari come in for Morocco. 28 years of age and she get betta experience
70mins- Good run by Senegal player making move into Morocco box 18 space
68mins - Senegal get chance for di Morocco front of goal, but noting come out of am oooo
FREE KICK
65mins - Ndiaye na confam goalkeeper, see as she dey block evri ball wey dem fire to di goalpost, she no wan give di Morocco team any chance tp score again
63mins- Fatima Tganaout do some incredible dribbles for dia side of Senegal box 18, she fit score? Oh no, she fire shot but Senegal goalkeeper Ndiaye catch am
60mins- Senegal dey badly find goal ooooo, how dem go take score like dis as Morocco defender stand gidigba.
Morocco 1 - 0 Senegal
55mins - SUBSTITUTION for Senegal
50mins- D Senegal team dey pumped wit energy looking for a equaliser wey fit make dia mind be at rest, But no go don show ooo, na so so attempt
47mins- SUBSTITUTION' Sakina Ouzraoui don comot for Imane Saoud. Morocco dey hope say dis dia sub go change di game small as Sakina no see goal score for first half.
46mins - Di second half of dis game don start and di player look like say giner dey dia body afta di break

Wia dis foto come from, Getty Images
FIRST HALF
HALF-TIME
45+6mins - Dis goal really mean alot to Morocco as dem dey do evritin possible to defend am against di Senegal team.
Morocco 1 - 0 Senegal
45+2mins- Yasmin Mrabet score a beautiful penalty
GOOOOAAAAALLLLLLLLLLLLLLLLL
PENALTY!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!
Di referee don award penalty give Morocco ooooooooooo. Dis na dia chance to shine and put diasef ahead of di Lionesses of Teranga.
Di goalkeeper give Morroco player a jab for mouth inside di box 18.
45+1mins - Senegal goalkeeper Adji Ndiaye don chop yellow for a hard tackle inside di box 18. Dis fit spell serious doom for di Senegal team and di referee dey try check which decision go come.
6MINUTES ADDED TIME
43mins- Di Morocco side dey hot and dem no wan gree as host kontri
40mins - THROW-IN for Senegal, jersey number 2 Mareme Babou step forward to make di throw. See as she dey use her cloth wipe di ball like say na long throw-in she wan do enta net.
37mins- Senegal goalkeeper Adji Ndiaye don dey save di team since oooo, she no gree make any goal enta di back of di net
35mins- A good chance don coome for Morocco again throguh jersey number 10 Najat Badri wey dey carry di ball go, oh no, anoda long shot wey go ova di goalpost again.
Ghizlane Chebbak for give Morocco dia lead but she miss am. Di second defender no gree oooo
33mins- Ghizlane Chebbak push forward wit di ball, she dribble di first defender, di goalkeeper don rush out ooooo. Shey dis na goal wey she g score. Haaaaaaaaaaaaaaa, she play am wide oooo
WHAT A CHANCE MISSED
32mins - FREE KICK for Morroco, dem take am charply wit a long cross, but Senegal defenders no greee and dem make sure say di ball return
Jersey number 17 for Senegal Hapsatou Diallo don chop yellow card afta e fall Morocco player wit hard tackle
30mins- YELLOW CARD. Anoda hard tackle
29mins- Morocco looking for a solution wey go give dem goal, striker Sakina Ouzraoui wit jersey number 19 dey play wit confidence for front in search of goal
Morocco 0 - 0 Senegal
GOALKICK for Morocco. Goalkeeper Khadija Er-rmichi step forward to kick di ball.
19mins- Mama Diop of Senegal carry di ball, wit great run into Morocco box 18, anytin go sup? E neva clear as she dey try dribble enta di gaolpost, but she lose di ball
15mins- Nguenar Ndiaye carry di ball enta Morocco box 18, e push di ball again, wit BIG shot. Oh no, e go va di bar
14mins- THROW-IN for Senegal. Dem enta di midfield, good attempt into Morocco boz 18, dis player dey carry ball run o.
10mins- Morocco dey really pressure dis Senegalese team but dem no wan gree too.
8mins- ANODA CHANCE for Morocco, oh di flag go up. Offside position.
5mins- CHANCE!!! Good chance for Morocco, good driblle for front of post. Sakina Ouzraoui for put di ball for back of Senegal net, but di goalkeeper stop am
3mins - Di Morocco team dey try penetrate into di Senegal box 18 but di defence dey strong for now and all defenders dey on standby.
0mins- Di game between Morocco and Senegal don start and dis go determine who dey o=go into di quarter-final.
Welcome to dis live commentary!
Morocco 0 - 0 Senegal

Wia dis foto come from, Getty Images










