'I want make I reach heaven make dem tell me say na seven billion souls you win for us' - Tomike Adeoye
- Author, Tunde Ososanya
- Role, Senior Journalist
- Reporting from, Lagos
Nigerian brand influencer Tomike Adeoye for di first episode of BBC News Pidgin Wetin dey? tok about how influencing don turn jobless youths to pipo wey get work wey dem dey do.
Tomike aka Olori Ebi say she dey veri happy wit how influencing dey change lives of young Nigerians.
"If to say evribodi dey wait make govment create job and give dem job opportunities, hunger go wire many of us. Tank God say we get influencing," Tomike tok.
Reacting to some pipo wey no see influencing as real work, she say: "Influencing no be joke oh. To dey develop new ideas, new ways to tell pipo, in short, for me influencing sef, apart from to dey on camera and dance, influencing na spiritual tin oh.
"Becos make you open your mouth, make you tell pesin say, 'Dis hair wey I wear na di finest hair wey you go ever see', and make pesin take your word for am, go buy am, no be small tin oh.
"So even for me, I dey pray for brands wey I dey represent, I go say, 'God, make dem sell oh, make e no just be cho cho cho, make workings show, and pipo wey buy am, make dem no get issue'. Becos at di end of di day, if somtin happun, dem go say, 'na you influence me go buy am'."
'I be representative for Jesus for my industry'
Tomike wey dey open about her faith and dey encourage pipo on di powers of prayer, say she be representative for Jesus for her industry and di world.
"Becos say I dey open about my faith, e get some kain tins wey you no suppose dey see me dey do, e get some kain clothes wey you no suppose dey see me dey wear, e get some kain tins wey you no go dey see me dey tok becos I be representative for Jesus for my industry, I be representative for Jesus for dis world," Tomike tok.
Di mother of two, wey bin study microbiology, say she want make pipo change dia perspective about faith and get personal relationship wit God.
"Di kain legacy wey I wan leave, I want make I reach heaven make dem tell me say, 'Na seven billion souls you win for us. Just becos say you dey on dat Instagram and YouTube and Snapchat and TikTok', say, 'na seven billion souls you win. Take your mansion'. Dat kain tin, na dat kain tin go sweet me," she tok.
Na Mobolaji Olatunde shoot and edit am






