'How Sister Agnes ginger pipo even wen I bin wan stop'

Wetin we call dis Video,
'How Sister Agnes ginger pipo even wen I bin wan stop'
    • Author, Faith Oshoko
    • Role, Journalist
    • Reporting from, Lagos

Content creator, Agnes Bada, find fame from sick bed for 2020 wen she decide say she go show wetin she bin reason say go be cringe content.

She follow BBC News Pidgin tok about di sickness wey ginger am to comot wit di igbotic singing, afta years wey she dey do wetin she bin call, "fine girl singing" even afta plenti push from her family.

She tok say she bin dey for school wia sickness bin hold her for days, and as she no like dey unproductive, she run di Sister Agnes character and she go viral.

But di ginger to just sing wit her natural voice ginger am to wan stop dis content, until she hear from her audience as to how her content dey make pipo happy sotay, e help one of her fans put to bed.

Na Idara Monday shoot and edit am