Motirolaoluwa - Di seven-years-old boywonder music producer
- Author, Adesola Ikulajolu
- Role, BBC News
- Reporting from, Lagos
You don see seven years old wey sabi play drums, play keyboard and come still sabi music production? Na Motirolaoluwa Emmanuel di young multitalented instrumentalist be dat.
Motirolaoluwa dey seven-years-old and im skills dey totori pipo as e dey play for churches, weddings, birthdays and oda social events for Nigeria.
At im young age, Motirola wey dey primary school also sabi music production and e tell BBC News Pidgin how e take start dis journey.
Seven years old Motirola win awards as best drummer and keyboardist for music minds legacy and di youngest drummer and keyboardist for Nigeria, for one competition wey e go for.
E say na im papa bin teach am di basics of how to play di keyboard while e come learn more on e own.
Di kain music wey Motirola like to play and produce na Gospel hip-hop and rock.
Di mother of di seven years old boy, Mrs Esther Emmanuel tok say dia family love music and Motirola dey balance am wit dia academics.
Produced by: Adesola Ikulajolu
Shot/Edited by: Gift Ufuoma






