'You no need to dey beg to make money' - Man living wit disability open workshop to discourage begging for Kano
'You no need to dey beg to make money' - Man living wit disability open workshop to discourage begging for Kano
Inside di city of Kano, Northwest Nigeria wia di common practice na to see beggars for roadside dey beg money for dia daily income just to survive.
Dis na wetin Aminu Ahmed Tudunwada see wey make am start one small workshop wia dem dey build tricycle to help pipo living wit disability to dey move around di city, and to discourage begging by giving dem work for im workshop.
Tudunwada imsef na physically challenged man wey dey train pipo living wit disability di skill of building tricycle and making money for demsefs and dia family.
E dey see beyond di disability of dis pipo, and e dey discourage dem make dem stop to dey beg for street and join am for im workshop wia dem fit make money.

Produced and filmed by Abubakar Maccido & Mobolaji Olatunde






