Three-year-old Ghanaian wey dey totori pipo wit her ogbonge hairstyling talent

Wetin we call dis Video, Three-year-old Ghanaian wey dey totori pipo wit her ogbonge hairstyling talent
Three-year-old Ghanaian wey dey totori pipo wit her ogbonge hairstyling talent

Three-year-old Lordina Nancy get one talent wey pipo dey spend money and years to learn, she sabi make hair.

Di little Ghanaian star wey don become internet sensation no learn how to make hair.

According to her mama, na one day she just begin dey help her make customers dia hair for her shop.

Lordina wey pipo nickname 'serious madam' sabi do different hairstyles, wey dey make women look fine.

Her mother Aminu Yahaya tok say she dey very impressed wit her daughter skills, as e don grow her customer base.

She add say despite Lordina skills, she dey go school and she go support any career she choose to pursue for future