'My plan for 3-year-old skilful Tobenna na make e play for Super Eagles one day'

Wetin we call dis Video, 'My plan for 3-year-old skilful Tobenna na make e play for Super Eagles one day'
Read am in 1 mins

One three year old Nigerian boy dey totori pipo for social media with im football skills.

Tobenna Uchendu go viral last year afta im parents post video of am online wia im dey run wit di ball at di age of 1year and 9months.

Hundreds of thousands of pipo watch dat video - and di family say dem dey very happy for im progress.

Now at di age of three years im parents dey hope say im go continue wit im development for di game and one day turn professional.

Obi Uchendu, Tobenna papa, say: "My plan for am as a father, but evritin still dey God hand, na make e one day play for Super Eagles."

Produced by Fiona Equere

Edited by Adekola Olawale