Jake Paul beat Mike Tyson

Foto of Jake Paul and Mike Tyson inside ring

Wia dis foto come from, Getty Images

Jake Paul don beat veteran boxer Mike Tyson for dia bout.

Novice boxer Paul, 27, go take on 58-year-old Tyson at di AT&T Stadium in Dallas.

Paul win di fight by unanimous decision.

One judge score am 80-72 wit two judges wey see am as a 79-73 win for Paul.

Dis na di 11th victory for Paul 12-fight career – im one defeat na against boxer and Love Island star Tommy Fury.

Mike Tyson now don get seven defeats on im professional record.

Di 58-year-old, wey dey compete for di 59th time, don lose im last three fights, although im most recent trip to di ring in a professional capacity prior to dis fight na back in 2005.

Foto of Jake Paul and Mike Tyson inside ring

Wia dis foto come from, Getty Images

"Mike Tyson, na such an honour. Make we hail Mike, di greatest to ever do am. We no go dey hia without am today,” Jake Paul tok on Netflix.

E add say “Wit am, dis man na icon. Na just honour to fit fight am. Na really tough fight. I bin expect am to be."

"Im na exactly as as I reason am. One of di greatest to ever do am. An icon.

"I bin dey try to wound am small. I dey fear say im go wound me but I domy best.”

Mike Tyson slap Jake Paul for dia weigh-in ahead of Friday controversial heavyweight fight in Texas.

Afta both men don weigh in, Paul crawl across di floor befor rising up to Tyson eyeline for di traditional final head-to-head.

Tyson refuse to engage wit Paul temper for much of fight week, but slap im opponent for face, prompting security and team members to rush in to separate di fighters.

Mike Tyson, di 58-year-old former heavyweight champion just recover from stomach ulcer, na im face 27-year-old YouTuber-turn-boxer Jake Paul in one boxing match for di AT&T Stadium in Arlington, Texas on Friday.

Di winner go, go house wit $40m in di fight and no title belts on di line.

Di showdown wey di Texas Department of Licensing and Regulation don approve, draw condemnation from di boxing community.

Na product of celebrity culture say some see as devaluing di art of dis sport.

Friday match na di latest of di matchups wey involve celebrities and former professionals.

How we take reach di point wia former professional recovering from sickness go go against pesin wey be im junior for 31 years in boxing ring — and potentially draw millions of viewers around di world?

Mike Tyson on side say say im dey happy to take di fight.

"I know say im na good fighter. I know say e prepare well,” Tyson tell Netflix.

Di 58 year-old fighter say "I prove nothing to anybody, only to myself. I just dey happy wit wetin I fit do."