'Na deliberate decision to keep my husband private' - Chef T
'Na deliberate decision to keep my husband private' - Chef T
Tolani Tayo-Osikoya, wey pipo sabi as Chef T, na Nigerian chef, blogger and influencer wey dey behind di brand Diary of a Kitchen Lover.
Her journey start for 2018 out of her love and passion for food.
Since den, she don grow to become one of di top cuisine chefs, food blogger wey also dey promote Kitchen aesthetics for Nigeria and beyond.
For dis exclusive interview with BBC News Pidgin, she tok about her journey, competition and how she dey balance all dat wit her roles as a wife and mother.

Video by: Helen Oyibo and Mobolaji Olatunde





