Staff and tourists dey among 25 pipo wey kpai for Goa nightclub fire for India
- Author, Vikas Pandey
- Reporting from, Goa
- Author, Harry Sekulich
- Read am in 4 mins
Twenty five pipo don kpai for one fire for one popular nightclub for di coastal region of Goa, India, local officials tok.
Belief be say majority of di victims na staff of di club for Arpora, North Goa, while tourists also dey among di dead.
Police believe say one gas cylinder bin explode inside di club kitchen, and cause fire to rip through di venue on Saturday at midnight local time.
On Sunday morning, officials say di death toll don rise from 23 to 25. Six more pipo dey for stable condition for hospital.
Di BBC don tok to witnesses at di scene wey describe scenes of panic for di bustling nightlife area.
"Di fire bin dey mainly concentrated around di kitchen area on di ground floor," Goa Director General of Police Alok Kumar tok.
"Di fire occur around midnight. E don dey under control."
Dem find most of di bodis around di kitchen "wey suggest say di victims bin dey employed at di club," Kumar add.
Goa chief minister Pramod Sawant tell journalists say three pipo die from burn injuries, while odas die by suffocating.
E say "three to four" tourists don die but e no provide dia ages or nationalities.

The Indian Express report say di fire beak out for one club called Birch by Romeo Lane for Baga, wey dey located for one of di coastal region most popular beaches.
Di area wia di fire occur dey lined wit similar nightlife hotspots, wia tourists and partygoers dey go.
One chef wey dey work for one nearby venue tell di BBC say e know some of di workers for di Birch club.
"Pipo from all over di kontri and also from Nepal dey work for different clubs for Goa," e tok.
"I dey really worried for some pipo wey I know for di club. Dia phones don off."
Rescue efforts still dey go on for di early hours of Sunday morning. Crews dey comb through di charred wreckage to determine di cause of di fire.
Heavy security presence remain for di scene on Sunday morning, and di doors to di nightclub dey shut and dem no allow anybodi go inside.
Di BBC see wetin appear to be charred and melted remains of chairs, tables and plants for one corner of di club.
One eyewitness say na usual Saturday night and holidaymakers bin dey enjoy demsefs.
E say: "I bin dey outside di club wen I hear screams, I bin no first understand wetin dey go on.
"In a bit, e become clear say massive fire don break out. Nobodi fit do much. Di scene just dey horrific."
Rescue workers don take di bodis of di victims to Goa Medical College for Panaji.
One of di firefighters for di scene tell di BBC say dem still dey identify di victims and go den notify dia families.
Formal inquiry into di cause of di fire don dey launched, di chief minister tok.
"Dose wey dem find responsible go face most severe action under di law – any negligence go dey dealt wit firmly," Dr Sawant tok.
"I dey deeply grieved and offer my heartfelt condolences to all di bereaved families for dis hour of unimaginable loss."
Prime Minister Narendra Modi call di Goa fire "deeply saddening" inside one post on social media.
Goa na former Portuguese colony on di Arabian Sea. Im nightlife, sandy beaches, and resorts dey attract millions of tourists annually.
About 5.5 million tourists bin visit Goa for di first half of di year, govment data show, and na 270,000 visit from abroad.
India don see a number of deadly fires at entertainment venues in recent years.
Fire for one three-storey building bin kpai 17 pipo for di southern city of Hyderabad for May, while one hotel blaze for north-east Kolkata kpai 15 pipo a month earlier.
Last year, 24 pipo kpai for one amusement park arcade for di western state of Gujarat afta visitors bin dey trapped inside due to di collapse of one temporary structure for di entrance. One official review later find out say poor safety standards bin contribute to higher death toll.











