At least 11 die for mass shooting for South Africa

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
- Author, Jessica Rawnsley
- Read am in 2 mins
At least 11 na im dem don kill for mass shooting for one hostel for South Africa.
Fourteen odas wound wen gunmen storm di venue for Saulsville township, west of di capital Pretoria, early on Saturday. A three-year-old dey among di pipo wey dead.
"At least three unknown gunmen enter di hostel wia a group of pipo dey drink and dem start to shoot anyhow," police tok-tok pesin Brigadier Athlenda Mathe tok.
Di reason for di shooting no dey clear and dem neva arrest anybody.
Dis na di latest for series of mass shootings wey don happun di kontri wey don see plenty crime in recent years.
Tori be say di gunmen enter di compound around 04:30 local time (14:30 GMT) and open fire on top group of men wey dey drink.
One 12-year-old boy and anoda 16-year-old girl dey among those wey die for di attack.
"I fit confam say a total of 25 pipo na im dem shoot," Mathe tok.
Describing di hostel as "illegal shebeen", she add: "We dey get serious challenge wen e come to these illegal and unlicensed liquor premises," wia she say di majority of mass shootings dey happun.
"Bullet dey also touch innocent pipo during di crossfire," she tell public broadcaster SABC.
South Africa get one of di highest murder rates in di world, at 45 pipo per 100,000 according to 2023-24 figures from di United Nations Office on Drugs and Crime.
Some 63 die evri day between April and September, according to police data.








