17 facts you need know bifor di Oscars

Wia dis foto come from, Disney
- Author, Steven McIntosh
- Role, Entertainment reporter
- Read am in 11 mins
Hollywood bin get anoda interesting year: Deadpool face off wit Wolverine, Blake Lively and Justin Baldoni sue each oda, Inside Out 2 conquer di box office and Joker sequel no even come close.
Meanwhile, di Oscars race dey occur inside all di kasala wey follow di wildfires wey wey scata Los Angeles wey destroy thousands of homes.
Awards season sef bin get dia fair share of scandal. The Brutalist use of AI plus Anora lack of an intimacy co-ordinator trend for Twitter teacup.
Also, one genuine controversy happun wen some historic tweets wey Emilia Pérez bin post mostly between 2019 and 2024 bin nearly bring her down.
Ahead of di Academy Awards wey go happun on Sunday (2 March), here na 17 of di quirks, trends, patterns, and record breakers from dis year batch of nominees.

Wia dis foto come from, Getty Images
1. Dis na di first time two musicals go dey nominated for best picture for more dan five decades.
Wicked and Emilia Pérez na di first musical pair to dey nominated for top prize since Funny Girl and Oliver! for 1969.
Di revival of musical na partly sake of say e dey two times easier to score best picture nomination nowadays, afta dem expand di top category to 10 slots.
Di last musical to win best picture na Chicago for 2003.

Wia dis foto come from, Getty Images
2. Adrien Brody don already hold one Oscars record, and e fit break anoda one
Di US star currently na di youngest ever winner of best actor – e be 29 wen e win for im performance for 2002 The Pianist.
But dem no nominate Brody again until dis year, wit im nod for The Brutalist.
If e win again, e go become di first pesin to win di leading actor category wit im first two nominations.
Only seven oda actors currently get 100% win rate for di Oscars from two or more nominations - Vivien Leigh, Hilary Swank, Kevin Spacey, Luise Rainer, Christoph Waltz, Helen Hayes and Mahershala Ali.

Wia dis foto come from, tchalamet/Instagram
3. But Timothée Chalamet na major threat.
Di Dune and Wonka star na Brody toughest competition for best actor, thanks to im very correct acting of Bob Dylan for A Complete Unknown.
If e win, Chalamet no go only stop Brody winning streak, im go also collect Brody record as youngest-ever winner. Plenty tok no dey dia - Chalamet go be just 10 months younger dan Brody bin dey wen im bin win.

Wia dis foto come from, Getty Images
4. Netflix Emilia Pérez fit follow di dubious pattern for streaming films.
E fit get di most nominations, but di Spanish-language musical fit share di same fate as oda recent streaming films wey dey only get plenty nomination, but no dey to win.
- Di Irishman (Netflix) win zero Oscars, from 10 nominations
- Mank (Netflix) win two out of 10
- Di Power of di Dog (Netflix) win one out of 12
- Killers of di Flower Moon (Apple) win zero out of 10
Emilia Pérez dey strong for some categories, but as usual, e no sure say e go clear di board.
Only one streaming film don ever win best picture - Apple's Coda – wey bin get only three nominations overall.

Wia dis foto come from, Getty Images
5. Two Succession stars share one disadvantage.
Kieran Culkin and Jeremy Strong both dey nominated for best supporting actor, for dia performances for A Real Pain and Di Apprentice respectively.
But na just di two of dem, dem bin nominate for dat category wey no come from best picture-nominated films.
Absence of A Real Pain from di best picture category no suppose stop frontrunner Culkin from winning. Di last pesin wey bin win dat category without best picture nomination na Christopher Plummer for 2012, for Beginners.
Every actor for di category dis year na first time Oscar nominee, except Edward Norton, wey dem don nominate three times bifor.
6. Di Substance na di first body horror dem go nominate for best picture, and di seventh horror overall.
Di oda six na Di Exorcist, Get Out, Di Silence of Di Lambs, Jaws, Di Sixth Sense and Black Swan.
Di Substance na strong contender for best make-up and hairstyling, di category wia di winners dey usually overlap wit di acting winners. Dis one fit work in Demi Moore favour wey dey tight best actress race.

Wia dis foto come from, Getty Images
7. Isabella Rossellini dey nominated for one eight-minute performance for Conclave, but dis no be di shortest for Oscars history.
Beatrice Straight bin win di same category, best supporting actress, for her role for Network, wey bin last 5min 02sec.
Dame Judi Dench only dey marginally ahead, winning for one performance for Shakespeare in Love wey last 5min 52sec.
Winners aside, di shortest nominee na Hermione Baddeley performance for 1959 Room at di Top, wey last just 2min 19sec.
On di mata of durations, Di Brutalist (3hrs 35mins including intermission) go be di number four longest best picture winner of all time, afta Gone Wit di Wind, Lawrence of Arabia and Ben-Hur.

Wia dis foto come from, Getty Images
8. Sing Sing star Colman Domingo dey nominated for best actor, just one year afta im last nomination for di same category for Rustin.
Dis na big achievement, no doubt. But im still get long way to go to fit catch up wit Bette Davis and Greer Garson. Dem two don manage five consecutive Oscar nominations for di 1930s and 40s.
Just behind dem na Al Pacino, Elizabeth Taylor, Marlon Brando, Thelma Ritter and Jennifer Jones, wey bin score four back-to-back nominations.
Bradley Cooper, Renée Zellweger, Russell Crowe, Glenn Close, Jane Fonda, Meryl Streep, Jack Nicholson, William Hurt, Richard Burton, Deborah Kerr, Gregory Peck, Ingrid Bergman, Gary Cooper and Spencer Tracy bin all manage three.
9. All five best actress nominees come from films wey dem also nominate for best picture.
E fit no sound like serious mata, but na di first time wey dis dey happun since 1977.
Di believe be say di historic lack of overlap between di two categories na sake of say di Academy bin dey less likely to give female-focused films di top prize.
But dat trend don shift in recent years, wit films wey feature female leads like Nomadland, Coda and Everything Everywhere All At Once scoring best picture.

Wia dis foto come from, Studio Canal
10. Before Sebastian Stan nomination for Di Apprentice, only seven oda actors bin dey Oscar-nominated for playing di role of a US president.
Frank Langella bin get recognition for acting as Richard Nixon, while Daniel Day-Lewis and Raymond Massey both nomination for playing Abraham Lincoln.
Sam Rockwell bin get nomination for playing George W Bush, Alexander Knox for Woodrow Wilson, and James Whitmore for Harry Truman.
Maybe di one wey stand out most na Sir Anthony Hopkins wey bin get nomination twice for acting as two different presidents for separate films - once as Nixon and anoda as John Quincy Adams.
Stan dey slightly different onto say im act as Trump for im younger years as a real estate tycoon, instead of during im tenure as president, but we go still add am as worthy of introduction into dis exclusive club.
11. Robbie Williams biopic Better Man dey nominated for best visual effects, but im also get connection to two oda films for di race.
Di British singer track Swing Supreme show one very important scene of Emilia Pérez, while im former Take That bandmates feature for di beginning of Anora as remix of Greatest Day dey play for one nightclub.
Im importance for di film make di remaining members of Take That to perform di song for dis year Bafta Film Awards.

Wia dis foto come from, Getty Images
12. Ralph Fiennes fit be good omen for Conclave.
Di last two time di British star bin get nomination for best actor, for Schindler's List and Di English Patient, im film win best picture.
If Conclave win, Fiennes go set record for appearing in most best picture winners, becoming di only actor wit roles inside four (di od ana Di Hurt Locker).
However, Edward Berger absence for best director category go seriously weaken Conclave chances.
Only six films don ever win best picture without corresponding director nomination.
On di plus side, three of dem bin happun last 12 years (Argo, Coda and Green Book), suggesting say dis one no be di kain obstacle wey e bin be before.
Why dem no nominate Berger?
One possible factor na say, unlike di five directors wey dem nominate, im no write or co-write im fil screenplay. Conclave na adoption from Robert Harris novel by British screenwriter Peter Straughan.

Wia dis foto come from, Getty Images
13. Diane Warren really wan win.
Di songwriter score her 16th best original song nomination dis year, for writing Di Journey, from Di Six Triple Eight.
But Warren never, ever win. Wit Emilia Pérez campaign damage and potentially splitting votes wit two songs for di category, dis year fit finally be her year?
She definitely hope so. Earlier dis month, wen one film account on X ask followers: "Which Oscar winner go make you happiest?" Warren brilliantly reply: "Me!"
14. Wicked get one tall hill to climb to win best picture, as per im miss both directing and screenplay nomination.
E sha score several technical nods as well as acting nominations for Cynthia Erivo and Ariana Grande, but none of di two be frontrunners for dia category.
Di last film to win best picture without corresponding win for director, screenplay or acting category na Rebecca for 1942.

Wia dis foto come from, Getty Images
15. Two nominees dey follow dia mama footsteps.
I'm Still Here star Fernanda Torres dey nominated for best actress - afta her mama Fernanda
Montenegro become di first Brazilian nominee for di same category for 1999 for Central Station.
Meanwhile, Conclave star Isabella Rossellini mama, Ingrid Bergman bin dey nominated five times for her career, winning two times.
16. Anora director fit become di fit pesin to win four Oscars for di same film.
As Sean Baker bin get hand for so many aspects of di film production, im fit personally win best picture, editing, director and screenplay.
Nobody don ever do dis before.
Walt Disney bin win four Oscars in di same night for 1953, but for inside four different films.
And Parasite Bong Joon-Ho bin really come close for 2020, but as di best international film prize technically dey go to di kontri wey submit am instead of di director, im bin only carry three go home for im own trophy cabinet.
If Anora win di top prize, e go be di second year back to back wey di director of best picture dey co-wins wit im wife. Baker and wife Samantha Quan go follow Oppenheimer's Christopher Nolan and Emma Thomas.
Anora would go also be di first 18-rated film to win best picture since Di Departed for 2007.

Wia dis foto come from, Dream Well Studio
17. E dey official: Di cat for Flow im name na Flow.
Di entertaining film about one cat wey bin survive one flood na one dark horse or film wey for no mata for di animated film category but e become ogbonge competition, afta e beat box office powerful Inside Out 2 and Di Wild Robot to win di prize for di Golden Globes.
"As we work on Flow, di cat bin no get name, "Di film director Gints Zilbalodis tok earlier dis month. "We just call am di cat.
"I don hear from plenty pipo say dem tink say im name na Flow. Pipo don even dey name dia cats Flow now! So I tink we fit call di cat Flow."









