Nigeria demand full investigation as Uganda dey torchlight death of Nigerian footballer wey die for shopping mall

Wia dis foto come from, Vipers Sports Club/X
- Author, Basillioh Rukanga
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
Nigeria goment don call for full investigation into di death of Nigerian footballer for Uganda, Abubakar Lawal, under circumstances wey no clear at all.
Oga of di Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom), Abike Dabiri-Erewa, say di acting Nigerian high Commissioner for Uganda , Ambassador Shama Shanga don also demand make dem do full autopsy and chook eye well-well di circumstances wey cause dis unfortunate incident.
For statement, Dabiri-Erewa tok say "E dey veri pathetic and e appear suspicious. We dey demand a thorough investigation. No cover up at all . E dey so sad!."
She add say "di Nigerian goment go make sure and demand thorough and transparent investigation".She condole wit di family of di di deceased.
Nigeria goment dey react afta police for Uganda confam di death of di Nigerian footballer.
Meanwhile, Police for Uganda still dey investigate di death of di Nigerian professional footballer wey allegedly fall from one shopping mall for capital Kampala.
Abubakar Lawal wey dey 29 years old allegedly fall from third floor balcony for Voicemall Shopping Arcade wia e go to visit im Tanzanian friend.
Dem carry am go hospital wia dem pronounce am dead, na so police tok.
Dem tok say Lawal friend Omary Naima bin leave am for her room wey be part of di mall building - and dey prepare tea before di incident happen.
Lawal na striker for local team Vipers Sports Club. Dem don express sadness over di "untimely passing of our beloved player".
Tributes don dey pour in for di footballer, wey don dey wit Vipers since 2022 afta e do two years play for Kigali Rwanda. For 2023 e help Vipers win di league and cup double.
Di club say "Lawal (man from Sokoto) na unique pesin. E get big heart of gold. E care about pipo and dey go out of im ways to help pipo. E dey incredibly generous".
"We mourn di sudden death of our ex-player Abubakar Lawal earlier today. Make God grant am eternal rest," na wetin im former Nigeria team Nasarawa United tok.
"E dey had to take say you Lawal no dey again. You dey kind, talented, jolly and loving person na him you be. We go miss you forever bro," na wetin Ugandan footballer Mustafa Kizza write.
Local tori pipo say di matter don bring up more questions dan answers as plenty tori dey fly unto how di player take die.
Some tori pipo bin report say e die via motorcycle accident. Police say di exact circumstances of im death dey under investigation.
"Authorities dey retrieve CCTV footage and dey conduct thorough interrogation to establish di exact circumstances wey surround di incident." Na so police tok.
Police don retrieve some items wey belong to di deceased player including two smart phones, shoes, headsets and training kit.
"Further updates go show later as di investigation dey progress," na so police add.









