Selena Gomez announce her engagement to Benny Blanco

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Faith Oshoko
- Role, BBC Pidgin
- Read am in 4 mins
US music star and actress Selena Gomez don announce her engagement to American music producer, Benny Blanco.
She make di announcement for her social media say, "forever begins now.."
Dis na about one year into her relationship wit Blanco.
Celebs don dey celebrate her.
Her celebrity bestie wey just finish her records breaking Eras tour, Taylor Swift don find her next gig as she announce say she go be di flower girl.
Rapper Cardi B also enta comment to express surprise.
Celebrity Chef Gordon Ramsey, wey bin get show wit di actress wey dem follow cook togeda tok say, "na bicos of di food."
As Benny Blanco imsef comment say, "hey wait... na my wife be dat."
Na since May Blanco don reveal say im see marriage for dia future for inside one interview.

Wia dis foto come from, Selena Gomez/ Instagram
Selena Gomez na popular singer and she recently make waves wit di popular song wey she do wit Nigerian star, Rema - Calm Down remix.
She be also di founder of her make up company wey dem dey call rare beauty.
Selena Gomez bin kind of agree say she dey date Blanco for December 2023, according to People, wen she comment for her fan page wey get di two of dem picture say, "E be my absolute evritin for my heart".
Dem make dia red carpet debut for di 2024 Golden Globes awards.
For Selena Gomez long career for di entertainment industry, she don dey linked to three pipo romantically. Di oda two na musicians The Weeknd and Justin Bieber.
For 2020, Benny Blanco reveal say im work wit Justin Bieber to write one of di singer hit song, "Lonely".
How dia relationship don progress
Selena Gomez first reveal am as her man for December 2023 afta about four year pause from dating. But she still reveal say dem bin dey date for six months till she publicly reveal am.
But bifor dem meet romantically, dem bin don hook up professionally for di 2019 single "I Can't Get Enough" wit Tainy and J Balvin.
Dem bin also work togeda for Selena song "Single Soon" for August 2023.
She and Blanco don reveal for interview say dem see marriage for dia future and Gomez even tell TIME for interview say dem get plan to adopt pikin for future.
Who be Selena Gomez?
Selena Gomez start her career as child star for di Barney show and Disney Channel wia she bin get di show Wizards of Waverly Place.
Now she dey part of of reoccuring characters for di new show based on dat series Wizards Beyond Waverly Place.
For 2022, she join Rema to release one of di biggest singles for di world wit di Calm Down lyrics.
She also dey act for di TV show Only Murders in di building wey she get one of two Golden Globe nominations dis year.
Di second one na for di feem wey she act inside, Emilia Perez.
Who be Benny Blanco?
Benny Blanco na producer wey don work wit many A-list stars wey include Justin Bieber, Ed Sheeran, The Weeknd, among odas.
Not only say e be producer, e also be songwriter (wey don win am multiple awards) and also don release some music as artiste wey include Eastside for 2018.
Di songwriter don also release cookbook as chef wey im call Open Wide.









