Why Israel dey attack Syria?

Aerial picture dey show smoke billowing following airstrikes for Damascus early on December 10, 2024.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Smoke for air afta airstrikes for Damascus early on Tuesday morning
    • Author, Jeremy Howell
    • Role, BBC World Service
  • Read am in 6 mins

Israel don carry out hundreds of airstrikes on Syrian military bases and also move dia troops into di demilitarised buffer zone for Golan Heights, dis mean say dem don extend di amount of Syrian territory wey don dey under Israeli control.

Israel say dem dey take dis steps to ensure di security of dia citizens, but odas say dem dey take di chance to weaken dia long-standing enemy.

Which airstrikes Israel dey carry out?

Map of Israeli airstrikes on Syria since 8 December

UK based group Syrian Observatory for Human Rights (SOHR) say dem don document more dan 310 strikes wey di Israel Defense Forces (IDF) don do since di fall of di Assad regime on Sunday.

Di strikes target Syrian army military facilities from Aleppo in di north to Damascus in di south, including weapons warehouses, ammunition depots, airports, naval bases and research centres.

Israel say dia actions na to prevent weapons make e no fall "into di hands of extremists" as Syria dey ready for post Assad era.

Wetin make Israel dey worry about chemical weapons?

Suspected chemical attack on Douma, near Damascus by pro-Assad forces in 2018

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, One suspected chemical attack on Douma, near Damascus by pro-Assad forces for 2018

Israel dey worry about who fit lay hands ontop chemical weapons wey Bashar Al-Assad claim to get.

E no dey clear wia and how many of dis weapons Syria get, but pipo believe say di former president Bashar al-Assad keep stockpiles of di weapons.

On Monday, UN chemical watchdog warn authorities for Syria say make dem ensure say any weapon dem get dey safe.

Ake Sellstorm wey be di former United Nations weapons inspector for Syria, wey now be associate professor in histology for Umea university for Sweden say Israel don dey target Syria chemical weapons capabilities wit dia airstrikes.

"Wetin Israel dey do na take away assets," e tell BBC. "Dis fit be pipo, e fit be facilities, or e fit be equipment.

Forces wey dey loyal to Bashar al-Assad use sarin gas for attack on one suburb of di Syrian capital Damascus wey dem dey call Ghouta for 2013. Tori be say di attack kill more dan one thousand pipo.

Accuse also dey say dem use chemical weapons like sarin gas and chlorine gas for oda more recent attacks.

Dr Sellstrom say rebel forces fit also get chemical weapons stockpiles, since e be say dem bin don use am against dia enemies for Syria.

"Assad bin get dis weapons in order to mark some strength for di conflict wit Israel, but e no use dem first hand. Now you get a totally different goment.

"Israel dey go in to clear am up… anytin dem get in terms of weapons."

Wetin Israel dey dey do for Golan Heights?

Map showing where rebel forces are in Syria and area of Golan Heights Israel has recently occupied.

Israel prime minister don announce say dia troops don seize di demilitarised buffer zone for Goran Heights, wey make am increase di amount of Syrian territory dem dey occupy for di region.

Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say dis na "temporary defensive position until dem find suitable arrangements".

"Israel don tok say dem wan prevent attacks like di one wey Hamas do for October 7 from happening for di Syrian side, na so professor Gilbert Achcar from SOAS University of London tok.

"But dis na opportunity to move forward and stop oda forces wey wan move closer to di border of di occupied zone."

Israel seizure of dat demilitarised zone don collect plenti condemnation from Arab kontris. On Monday, Egyptian Foreign Ministry describe di move as "occupation of di Syrian territory and flagrant violation of di 1974 Disengagement Agreement".

Syrian reports claim say Israel no only seize di buffer zone, dem cross reach 25 kilometres to Damascus, but Israel don deny am.

Wetin be di Golan Heights and who dey occupy am?

Golan Heights na rocky plateau for south-west Syria wey Israel dey occupy for more dan 100 years.

For 1967 Middle East war, Syria bombard Israel from di Heights, but Israel rapidly push back Syria forces and take ova 1,200 sq km of di area, wey dem don put under military control.

Syria bin try to take ova di Golan Heights during di 1973 Middle East (Yom Kippur) war, but dem fail.

Di two kontris sign armistice for 1974, and UN observer force don dey in place for di ceasefire line since 1974.

However, Israel take ova di area for 1981, a move wey di vast majority of international community neva reorganize.

Syria say dem no go do any form of peace deal wit Israel until dem comot from di whole of di Golan.

Most of di Syrian Arab inhabitants of di Golan Heights run from di area during di 1967 war.

As e be now, e get more dan 30 Israeli settlements for di Golan, wey be home to about 20,000 pipo. Israelis begin build for dia immediately after di 1967 conflict.

Under di international law, dem dey consider di settlements as illegal although Israel dey dispute am.

Di settlers dey live alongside about 20,000 Syrians - most of dem from Druze sect, wey no gree run wen dem capture Golan.

Israel security concerns dey justified?

Israeli troops deploy next to the security fence near the Druze village of Majdal Shams, in the Israeli-occupied Golan Heights (8 December 2024)

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Israeli army vehicle near Majdal Shams for di occupied Golan Heights on Sunday

Mr Netanyahu don tok say di presence of IDF for di buffer zone of Golan Heights dey temporary, but dia withdrawal dey dependant on di behaviour of di next Syrian goment.

"If we go fit establish neighbourly relations and peaceful relations wit di new forces wey dey pop up for Syria, dat na our desire," na so e tok. But if we no fit, den we go do whatever e take to defend State of Israel and di borders of Israel."

Israeli Foreign Minister Gideon Saar say dem do airstrikes on Syria military bases only to defend dia citizens.

"Dat na why we dey attack strategic weapons systems like for example, di remaining chemical weapons or long range missiles and rockets so dem no go fall into di wrong hands." Na so e tok.

Professor Achcar say "chemical weapons no dey widespread for Syria. Dem only dey for two or three spots. But wit ova 300 airstrikes, e mean say you dey try to weaken di kontri very much."

Israel bin consider Bashar al-Assad as "di devil dem know", but dem dey uncertain wetin go happun next.

"Dem dey expect say Syria go split between warring factions like Libya, and dem dey afraid say di new factions fit carry hostility come against Israel.

"Dem wan prevent any faction to go use Syrian Army weapons against dem."