Damascus don fall, Syria don free – rebels say Bashar al-Assad don run

Wia dis foto come from, Getty Images
Rebel forces don declare Syria "free", saying di "tyrant" President Bashar al-Assad don run.
Dis na di end a dark era and di beginning of a new one, HTS tok on Telegram.
Pipo wey bin run or imprisoned by di Assad regime half-century reign fit now home, di rebels tok.
E go be a "new Syria" wia "everyone live in peace and justice prevail", HTS tok.
Millions of Syrians wey bin don dey forced to japa don begin celebrate for social media.
"Oh God, I fit stop to cry. I dey imagine di day I go go back," Human Rights Activist Rima Flihan write on her Facebook page.
Syria don see di world largest refugee crisis, according to di UNHCR. Di organisation estimate say around 6.6 million Syrians dey forced to run from dia homes since 2011.
Syrian rebel groups bin near di capital city of Damascus from di north and south on Saturday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Islamist rebel group Hayat Tahrir al-Sham (HTS) wey collabo wit oda groups seize key Syrian cities wey include Aleppo, Hama and Deraa since dem start dia major offensive last week and dem say dia goal na to scata President al-Assad regime.
Di office of di Syrian President Bashar al-Assad bin deny say im don pick race comot from di capital.
Im office bin say im still dey work for Damascus but nobodi don see am. Dis make pipo begin check flights wey dey move in and out of Damascus to find out weda e don waka.
One unnamed US official tell our American partner CBS say Damascus "dey fall suburb by suburb to di rebels".
Syria interior minister tok say dia be a "very strong military cordon" around Damascus. E also claim say nobodi go fit to pass am.
Dis na as Israel military say dem dey help UN forces wey dey under attack for Syria to "repel di attack".
But HTS say dem get duty to defend goment, international and UN offices for Syria.
Fear turn di streets of Damascus to dey empty.
One tori pesin, Zaina Shahla wey dey live for di area say di mood for pipo wey dey city don move from "normal morning" to "sense of fear" as di news bin dey come say rebel fighters enta di Syrian capital.
She bin say, "many shops don dey close. I try enta one shop and dem tell me say dem don close dem no dey ansa anyone. Pipo dey hustle try buy bread, and some vegetables."
Di United Nations don alreadi start to withdraw 'non-critical' staff for Syria. Dis na according to di humanitarian coordinator for di kontri, Adam Abdelmoula.
But e still insist say di UN dey work for di kontri and say di tori say dem dey comot all dia staff na lie. Wetin dem dey do na just "strategically reduce dia footprint by say dem relocate non-critical staff go outside di kontri."
Di UN bin don record say since di beginning of dis leg of di kasala, at least 370,000 pipo don run comot dia house but dem dey fear say di numbers fit jump go 1.5 million.

Wia dis foto come from, Reuters
Bifor fear force many pipo enta house, protesters bin enta street for di suburbs enta street against President al-Assad order.
Videos for social media show as demonstrators bin dey celebrate di falling of di president late papa statue for di southern suburb of Jeramana.
Dem bin tear down anoda statue of Hafez as-Assad wey tanda as president from 1971 till e die for 2000, for Hama city on Friday.
Plenti world leaders don chook mouth for di kasala wey dey burst for Syria as e dey hot.
US President-elect Donald Trump tok say , "Syria na mess but dem no be our friend".
E add, for post on Truth Social say, "Di United States suppose no get anytin to do wit am. No be our fight. Make e dey go as e dey go, no chook mouth".
Di Polish embassy for Syria issue emergency appeal make all dia citizens for di kontri to comot now-now.
Dem dey also ask dia citizens make dem no enta Syria.
Jordan close dia border wit Syria on Friday, according to di kontri interior ministry.
Britain warn Syrian goment against di use of chemical weapons wey go "intolerable".
Wetin be di koko of wetin dey happun for Syria?

Wia dis foto come from, Reuters
Collabo of rebel groups wey HTS dey start offensive for northern Syria on d 27 November, wey be di very day wey Israel and Hezbollah ceasefire bin come into effect.
Afta years wey dem bin dey locked for frozen frontlines, Syria militants wey now get beta equipment and organisation enta sharparly and seize strategic towns and cities from di goment.
Dem capture Aleppo and Idlib for di north-west and later, Hama and di southern area for Deraa.
So who dey control Syria as at now?
Turkish backed factions launch seperate offensive near Aleppo wey bin dey controlled by Kurdish-led miliia alliance, wey be di Syrian Democratic Forces, dis na as Turkey see Kurds for Syria as threat.
Na ova half a million pipo die for Syria since one civil war bin start for 2011 wen President al-Assad goment violently crack down on peaceful pro-democracy protests.













