Wetin to know about Storm Darragh wey hit UK

One van driver die afta tree fall ontop am as Storm Darragh bin cause problems for UK after im 90mph winds cause power cuts, trees to dey uprooted and events and travel to dey cancelled.
One rare red weather warning bin dey issued by di Met Office to around three million people for parts of Wales and south-west England on Friday meaning say dangerous, potentially life-threatening winds bin dey expected.
Although dat warning don end now, yellow and amber alerts still remain in place as winds fit still reach up to 70-80mph and di risk of structural damage, fallen trees, flying things and large waves remain high.
According to di National Grid, tens of thousands of pipo no get power and some events and attractions - including Christmas markets, sporting fixtures and all Royal Parks - all don already dey cancelled today, with millions wey dem advise to stay at home.
Di storm make dem cancel many train services and flights.
Travel dey seriously affected around di country, with Cardiff Airport closing im runway until 11:00 GMT, rail services dey affected and National Express coach services also.
Di red Met Office red warning for parts of Wales and south-west England end round 11:00 GMT on Saturday, but amber warnings for further wind and rain still dey in place throughout Saturday evening.
Di Energy Networks Association say ova177,000 homes for England, Scotland and Wales still dey without electricity, and around 768,000 customers bin already dey reconnected.
Yellow weather warnings for wind will still dey in place across most of di UK until early morning on Sunday.
For Wales, one major incident don dey declared by Dyfed-Powys Police wey dey cover di counties of Carmarthenshire, Ceredigion, Pembrokeshire and Powys.
Di force tok say dem bin dey receive high volumes of calls about fallen trees and poor driving conditions.

Around three million pipo receive goment emergency alert for dia mobile phones on Friday evening wey dey give dem advice about di storm.
Na di largest use of di UK warning system and e dey make loud sound wey resemble siren wen e deliver to devices and e dey last for around 10 seconds.

All di Royal Parks for London bin dey closed on Saturday, including di Winter Wonderland attraction for Hyde Park.
Dem abandon Horse races wey dem bin plan for Saturday afternoon for Aintree for Merseyside and Chepstow in south Wales sake of di weather.
Di Premier League match between Everton v Liverpool, wey suppose happun for Merseyside Goodison Park, dey postponed.
Storm Darragh na di fourth named storm of di season afta Bert and Conall wey bin cause severe flooding last month.
Fotos of di damage wey Storm Darragh cause

Wia dis foto come from, BBC Weather Watchers/olly79

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Simon Harnaman

Wia dis foto come from, BBC Weather Watchers/RobJJ

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Reuters









