Mother wey hide her secret child inside drawer for three years from her partner and oda children

Drawer

Wia dis foto come from, CPS

Wetin we call dis foto, Di court hear say living inside drawer cause ‘catastrophic’ consequences
Read am in 3 mins

One mama wey hide her baby daughter inside drawer for di first three years of her life don chop jail sentence for seven years and six months for "extreme neglect".

Dem discover di girl wey prosecutors bin say, "never know daylight or fresh air", wen one visitor wey go dia house for Cheshire hear as she dey cry.

To protect di girl, we no go identify either she or members of her family.

Authorities sentence di girl mother, wey admit to four charges of child cruelty for one previous hearing for Chester Crown Court.

Judge Steven Everett say di woman don "starve dat little girl of any love, any proper affection, any proper attention, any interaction with odas, a proper diet, much-needed medical attention

“Na intelligent little girl wey now maybe don dey slowly come to life, from wetin be almost a living death inside dat room," e add.

Chester crown court

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Chester Crown Court hear say dem dey use syringe feed di girl cereal and milk

Di court hear say di mother hide di baby from her siblings by hiding her inside di drawer of her bed, and also keep her secret from her partner, wey sometimes dey stay for di house.

Rachel Worthington, from di Crown Prosecution Service, say di pikin no even respond to her own name wen dem find her, and dem bin dey leave her alone for long periods to "fend for herself" without enough food.

'Dem dey use syringe feed her with milk and cereal'

Di court hear say di girl bin dey severely malnourished, to di point say she look like a seven-month-old baby and not a three-year-old pikin, and dem dey use syringe feed her with milk and cereal.

She also get cleft palate and oda medical issues wey her mother no seek any treatment for.

Di offences cover a period from early 2020 to early 2023, wen dem discover di girl after visitor to di house hear noise upstairs and find her on di bed.

Dem call social worker to di house after di discovery, and she describe di “overwhelming horror” of wetin she see wen she enter di bedroom.

Di child dey with jaga jaga hair, deformities and rashes.

Wooden drawer

Wia dis foto come from, CPS

Wetin we call dis foto, Di pikin spend her life living inside di small wooden drawer

Di social worker say: "I look her mum come ask, ‘na dis place you keep her?’ Di mother reply matter-of-factly, ‘Yes, inside di drawer'.

"I dey shocked say di mother no show any emotion…

"E become an overwhelming horror say I probably be di only oda face [di girl] don see apart from her mother."

'Not part of di family'

Di court hear about di serious developmental issues di pikin - wey now dey in foster care - get as a result of di neglect.

For one police interview, di woman say she bin no know say she bin dey pregnant and she bin dey "really scared" when she give birth.

She say she no keep di baby inside di drawer under di bed all di time, and say di drawer no ever dey closed.

She tell officers say di pikin "no be part of di family".

Di mother wipe away tears as she describe how her oda children, wey she don look after well, no longer dey live with her.

Judge Everett say wetin di woman do "dey totally unbelievable".

"You attempt to control dis situation as carefully as you fit but by chance your terrible secret dey discovered," E tok.

"I no remember a case as bad as dis in my 46 years."